By: Mariam Ajayi
Update for lagos, Senior mehn lagos traffic pipo don drop bomb, bring report card say inside just nine months, na 1,409 road askident dem don witness con save about 670 souls.
Na number one tok tok person of traffic marras, Adebayo Taofiq, dey yan dis on Sunday.
Hin say na every day di oga kpatakpata of traffic marras, Olalekan Bakare, dey shout, emergency team need to join hand for dis askident control mata
E con drop serious warning-shot give all danfo drivers, dispatch riders, and leg-passengers make every body shine dia eyes, say some pipo village pipo naim dey follow dem enter road, everybody need to be careful.