Iranian security chief, Mohsen Rezaei, don tok say Iran reject US proposal to carry dem 60 percent enriched uranium go another country, and dem don already inform Russia wey been offer to keep am say di material go remain inside Tehran.
Meanwhile, wahala don burst for Strait of Hormuz after Iranian army report say one oil tanker catch fire because e jam naval mine inside di water.
Di Islamic Revolutionary Guard Corps (IRGC) still confirm say two other oil tankers wey hit mines during di night for di same Hormuz area don already dey abandoned by dem crew.