OBODO NAIJA

INEC Plan To Stop Result Magomago For 2027 Election.

todayNovember 13, 2026 6

Background
share close

INEC, don bring out fresh rules say na only results wey party agents konfamate from polling units dem go upload enter IReV portal for 2027 general elections.

INEC Chairmo, Professor Joash Amupitan, tok dis one on Thursday, November 12, 2026, for one siddon tok at Chatham House for London, and e konfamate say practice voting go happen on November 28, 2026, to test upgraded BVAS machines.

Meanwhile, Nigerians wey dey live for United Kingdom mount protest outside Chatham House after di meeting, block Professor Joash Amupitan motor, shout on top im head dey call am bad names, kon add say hin dey favor Presido Bola Ahmed Tinubu and di ruling All Progressives Congress(APC)

You go remember say on Monday, November 9 2026 , Amupitan disclose say INEC don remove 1,608,660 invalid voter registrations, remove 873 dead pipu for voters lists, and identify 54 pipu across 10 states wey allegedly do some kind mago mago during registration of voters, and hin tok dem do deal with dem better style.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds