Presido Bola Ahmed Tinubu don open one new 100 million naira house loan plan for Nigerians wey qualify, with steady 9.75 percent interest wey pesin fit dey pay small-small reach 20 years.
Inside wetin e yarn for him verified X handle on Tuesday, November 17, 2026, Presido Tinubu press mouth say any Nigerian citizen from 21 years old upward wey get steady work or business cash flow fit chop from di 1 trillion naira Ministry of Finance Incorporated Real Estate Investment Fund (MREIF) with just 10 percent first money down you nor need sabi any minister or big man for Villa before e reach your hand.
E confamate say over 2,300 hardworking Nigerians across 27 states don already collect 160 billion naira under dis same housing plan to hellep citizens stop to dey pay landlord tire.