OBODO NAIJA

Treat Gunshot Wound before Police Report -IGP Disu

todayNovember 20, 2026 10

Background
share close

Inspector-General of Police, Olatunji Rilwan Disu, don drag ear give doctors, nurses, and all hospitals for Naija inside one public-service video wey Nigeria Police Force and

National Orientation Agency (NOA) release on Thursday, November 19, 2026, say make dem treat anybody wey carry gunshot wunjure immediately without waiting for police report first.

IGP Disu press mouth say hospital workers no need police clearance before dem save life.

Under Nigeria law Compulsory Treatment and Care for Victims of Gunshots Act, 2017 every gornment and private hospital gas treat gunshot victims sharp-sharp so pipo no go kpai anyhow.

Any hospital or medical worker wey nor gree or delay treatment fit go prison for up to 15 years, pay fine, or face di two both of dem.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds