Serious kasala na im burst for Thursday morning for Badagry Expressway around Checkpoint Bus Stop as fire roast eight pipo like suya, after one Mazda bus go jam culvert.
According by report di driver driver lose control, say brake fail am for road, na so di bus throw backie, catch fire.
Na di Oga for Lagos State Emergency Management Agency, Dr Olufemi Oke-Osanyintolu, dey clear tatafo pipo dis mata say na serious overspeeding and wawa driving cause di askident.
Even with di fire, rescue team sti manage drag five adults, four men and one woman comot inside the burning motor, rush dem go Badagry General Hospital for sharp-sharp treatment.