OBODO NAIJA

Adeleke Fly Go Abuja For Tinubu 2027 Campaign

todayOctober 14, 2026 5

Background
share close

Osun State Govo, Ademola Adeleke, don comot for Abuja on Wednesday ahead of inauguration of APC 2027 Presidential Campaign Council, as video show am dey waka with im protocol team go meet private jet wey go carry am.

Di inauguration go hold for Banquet Hall of Presidential Villa, Abuja, as dem recently appoint Adeleke as Osun State coordinator for Presido Bola Tinubu 2027 re-election campaign.

Di appointment put am among APC coordinators wey go mobilise support for Tinubu ahead of di next presidential election.

Di inauguration go officially kick-start di campaign council work as APC begin preparations for 2027 general election.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds