By: Esther Daniel
Nigerian Army say troops from 65 Battalion don go gbab six suspected illegal bunkerers, dat is oil thief thief as dem dey fetch crude oil form di site inside Orile area of Lagos State.
According to the Army, dis one hapiun last week, the operation hapun after dem receive correct intelligence about dis oil thief thief.
Say During the raid, soldiers recover four drums, including two wey contain suspected illegally refined fuel, plus one white Ford bus and one tanker wey dem believe say dem dey use for the illegal operation.
The Army Commanding Officer of 65 Battalion, Lieutenant Colonel S. Adeojo, unto to di ogbonge movement even clap hand for di officers, say dem do well for the arrest.