News-auth

322 Results / Page 12 of 36

Background

National

NNPP Clear Marras On Who Be Dia Party Leader

By: Esther Ayoola National Vice Chairmo of New Nigerian Pipo Party  for Northwest, Sani Danmasani, don reveal tuk say oga Govo of Kano state, Abba Yusuf, na be di real leader of di party, no be Rabiu Kwankwaso. Im sukili dis one for inside statement, say according to NNPP constitution, anybody wey be sitting governor and party member automatically be leader, and na why Abba Yusuf take get dat position […]

todayJanuary 6, 2026 4

Sports

Chelsea Carry Liam Rosenior E As New Head Coach

By: Esther Ayoola Chelsea don carry Liam Rosenior to con be dia new men head coach, say dem wan build strong team and return to top football. Di Club confamate dis report for dia official website, say Rosenior sign contract wey go run reach 2032, afta e do well for France with Strasbourg and carry dem enter Europe for first time in 19 years. Chelsea tuk say Rosenoir show beta […]

todayJanuary 6, 2026 4

National

APC National Secretary, Wike No Be Our Member

By: Esther Ayoola APC National Secretary, Ibrahim Abdullahi Basiru, tuk say former Governor Nyesom Wike no be member of APC, so e no get right to interfere for party affairs. E yarn dis one for official APC X page afta Wike warn am make e no touch Rivers politics. Basiru tuk say as National Secretary, e get duty to protect APC and all im members and structures. E add say […]

todayJanuary 6, 2026 7

National

Minister Of Information Declare Say Tinubu Reforms Wan Show Beta Workings

By: Esther Ayoola Information and National Orientation Minister, Mohammed Idris, tuk say dis year budget na to make sure President Bola Tinubu reform dem dey yield better result. Idris yarn dis one for one ogbonge paper, wey dem call “A Defining Moment for Nigeria: Why Staying the Course Matters.” E tuk say di budget na to support wetin dey work and make sure plenty Nigerians fit enjoy better life faster. […]

todayJanuary 6, 2026 7

National

Ondo Govo Ginger Im Mehn To Deliver Key Projects

By: Esther Ayoola Ondo State Govo, Lucky Aiyedatiwa, enter area oh dey ginger mehn for all ministries, departments and agencies say make dem show workings, deliver projects and programmes wey people dey expect. Him yarn dis one on Monday for Ondo First Working Day Prayer Meeting for 2026 for Governor’s Office, Akure. Governor Aiyedatiwa sha beg citizens make dem support government by dey patriotic and responsible.

todayJanuary 6, 2026 6

Lagos

Lagos Pastor Nor Show Face For Police Station Over Rape Case

By: Esther Ayoola Police say Senior Pastor of Mountain of Liberation and Miracles Ministries, Chris Okafor, no honour invitation wey dem give am to report on Monday by 10am for State CID, Panti, Lagos, over alleged rape and other offences. Police Public Relations Officer, Abimbola Adebisi, tuk on Sunday say di invitation na order from Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, afta several complaints reach police. According to police, dem invite […]

todayJanuary 6, 2026 12

National

INEC Arrange Mehn For Voters Registration

By: Esther Ayoola Di Independent National Electoral Commission (INEC) don resume nationwide voter registration again and say dis na di second phase of Continuous Voter Registration for di obodo Naija. Chief Press Secretary to INEC chairman, Na Adedayo Oketola, confirmation dis particular mata give tori pipo on Monday Dis new phase come afta the first round of CVR wey end officially on December 10, 2025. INEC dey ginger say Nigerians […]

todayJanuary 5, 2026 7 6

National

FG Roll Out New Plan To Stop Exam Malpractice

By: Esther Ayoola Wi Federal Government don roll out new plan to fight mangomango for WAEC and NECO exams starting from 2026. Di announcement drop on Monday for Abuja, as Education Minister Maruf Alausa and Minister of State Professor Suwaiba Ahmed troway di mata comout. Dem tuk say di new move go tighten monitoring from start to finish and block every backdoor wey pipo dey use cheat for exams. Government […]

todayJanuary 5, 2026 6 2

National

President Tinubu select For Senator Magnus Abe Chairmo Of NUPRC

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don nominate former Senator, Magnus Abe as chairmo of di Nigerian Upstream Petroleum Regulatory Commission (NUPRC), plus 20 other pipo for boards of key oil agencies. Special Adviser to di Presido on Information and Strategy, Bayo Onanuga, tuk  for statement on Monday say Abe go lead NUPRC board together with other non-executive commissioners like Paul Jezhi and Sunday Babalola. Tinubu also nominate […]

todayJanuary 5, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app