News-auth

1021 Results / Page 10 of 114

Background

Lagos

Sanwo-Olu Free 43 Inmates As Lagos Dey Fight Overcrowding For Prisons

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don approve di release of 43 inmates from correctional centres across Lagos State on Monday, to hellep reduce overcrowding. Attorney-General and Commissioner for Justice, Lawal Pedro, say di release sef don show Gornment commitment to justice, fairness, and proper rehabilitation for inmates. Di inmates wey sti get prison sentence normally,  say dem carefully check dia character according to legal and administrative rules, […]

todayApril 7, 2026 7

Lagos

LASEMA Raise Alarm Afta Electrical Fire Hits Lagos Buildings

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don warn residents make dem dey careful with electrical things and report any emergency through di toll-free lines. Di warning follow two fire wahala wey hapun for different parts of Lagos on Sunday because of electrical surges. Head of Public Affairs, Afolabi Olawale, naim dey Konfam say, one fire happen for FESTAC Town Phase 2, where single-storey building catch fire afta […]

todayApril 7, 2026 4

Lagos

Lagos Begin Drag 45 People, Companies Go Court For Tax Wey Dem Owe

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don start to prosecute 45 pipo and companies wey dey owe tax of billions of naira. According to Attorney-General, Lawal Pedro (SAN) yarnings on Monday for Lagos, say dem don arraign di defendants for Lagos Revenue Court make dem pay di outstanding tax wey dem dey owe. Some of di pipo wey dem list na Chidi Ajaere Emmanuel wey owe N35.4 million, Ifeanyi Uzoaru […]

todayApril 7, 2026 4

National

ADC Accuse INEC Say Dem Dey Slow Dia 2027 Election Push

By: Esther Ayoola Di African Democratic Congress don accuse Independent National Electoral Commission say dem dey use style wan stop dem from fielding candidates for 2027 elections. For statement wey tuk tuk, Bolaji Abdullahi sign, ADC tuk say INEC don refuse to collect any letter from dem because one court case sti dey for Federal High Court. Di parti now dey press for INEC to quickly change dat decision and […]

todayApril 7, 2026 3

National

GenCos Beg NERC Make Dem Hike Light Tariff Afta Gas Price Rise

By: Esther Ayoola Electricity generation companies, Gencos like dis now don dey beg Nigerian Electricity Regulatory Commission, NERC, make dem quickly adjust electricity tariff afta Federal Gornment raise domestic gas price. CEO of Association of Power Generation Companies, Joy Ogaji, say delay in tariff review don dey worry dia body already and she yan dis one during interview on Monday. She explain say gas don cost, so any extra wey […]

todayApril 7, 2026 4

National

Resident Doctors Begin Nationwide Strike Today Over Allowance

By: Esther Ayoola Di Nigerian Association of Resident Doctors (NARD) don announce say dem go start strike from today, April 7, 2026, for federal and state hospitals all over Naija. Dem tuk say di strike happen based on gornment failure to pay di revised Professional Allowance and don reverse some health policies wey dem agree afta di 2025 strike. NARD say for dia National Executive Council meeting, dem decide say […]

todayApril 7, 2026 5

National

Three Kpai As Gunmen Do Fresh Attack Jos Community

At least three pipo don kpai as gunmen try attack Hyeipang community for Jos, Plateau State on Sunday, but security men stop dem and gbab one suspect. Plateau State Police Commissioner, Bassey Ewah, naim dey brief journalists on Monday about di attack, say e hapun, even as di state dey recover from di Palm Sunday attack Ewah explain say police, with other security agencies, don put more men join, including […]

todayApril 7, 2026 4

National

FG Declare Two Days Public Holidays For Easter

By: Esther Ayoola Federal Government don declare Friday April 3 and Monday April 6, 2026 as public holidays for Easter celebration. April 3 na Good Friday while April 6 na Easter Monday wey Christians go mark. Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo, drop diannouncement on Wednesday and congratulate Christians for obodo Naija and obodo oyinbo. E sti advise Nigerians make dem follow example of Jesus Christ by showing love, forgiveness, patience, […]

todayApril 1, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app