News-auth

1164 Results / Page 12 of 130

Background

National

Oluyede Tell Troops Not To Relax For Naija Bandits

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, don tell troops of Operation Fansan Yamma make dem continue serious fight against bandits and criminals for North-West. Im yarn dis one when he visit dia headquarters for Gusau inside Zamfara State, where e check how ready di soldiers be and discuss security wahala for di area. According to Oluyede, say Naija must be saved by all means, no excuse.

todayApril 21, 2026 11

obodo oyinbo

Cuba And US Hold Respectful Tuk For Havana To End Oil Blockade

By: Esther Ayoola Cuban gornment don konfamat on Monday for Havana say, dem hold tuks with United States officials as tension sti dey between both countries over US energy and oil blockade for Cuba. Deputy director general for US affairs for Cuba Foreign Ministry, Alejandro Garcia del Toro, naim dey konfam dis mata say US delegation include assistant secretaries of state, while Cuba side send deputy foreign minister level pipo […]

todayApril 21, 2026 14

Sports

Shaibu Open Tuk On How Naija Wan Take Train Football Coaches

By: Esther Ayoola Director-General of National Institute for Sports, Philip Shaibu, don tuk say Naija get serious shortage of coaches. Im yarn dis one during im visit to NFF office for Abuja on monday, where e also go pay condolence for late former NFA chairman, Ibrahim Galadima. Shaibu tuk say dem get two-year plan to work with NFF to solve di coaching wahala and improve sports for di country. Im […]

todayApril 21, 2026 11

Sports

Wolves Enter Championship With Five Games Remaining Afta Poor Season

By: Esther Ayoola Wolves don drop from Premier League afta bad 2025/26 season wey no go well at all. Dem lose 3-0 to Leeds for weekend, and for small moment dem sti get hope when Spurs draw late against Brighton. But West Ham draw with Crystal Palace on Monday night finish everything, dat one mean say Wolves dey go Championship. Na with five matches remaining, dem nor go fit escape […]

todayApril 21, 2026 17

Sports

Bournemouth Appoint Marco Rose As New Coach

By: Esther Ayoola Bournemouth don announce say dem don appoint Marco Rose as dia new head coach. Di German coach go take over from Andoni Iraola for summer as e sign three-year contract wit di club. Iraola self don tuk say e go comot when im contract finish for di end of dis season afta three years for di job. Na so Bournemouth dey prepare for new era under Rose […]

todayApril 21, 2026 12

obodo oyinbo

One Kpai As Trolleybus Crash Enter Supermarket For Austria

By: Esther Ayoola Nor be small wahala for Australia as trolleybus lose control and crash enter supermarket for Salzburg, Austria, kpai one wunjure Seven. Na Austria Red Cross dey konfamate dis incident, say despite effort to revive di victim, di person no survive. Dem say emergency responders rush go the scene and carry di wujured go hospital, with two pipo in serious condition. Authorities say di crash hapun for one […]

todayApril 20, 2026 13

National

FCT Teachers Drop Chalk, Start Indefinite Strike Over Govt Silence

By: Esther Ayoola Teachers wey dey work for gornment schools inside FCT don start one indefinite strike say Federal Gornment suppose do settlement for dem. When tori pipo waka go some schools for Area 10 Garki and Gornment Science Technical College for Area 3, dem see say everywhere dey empty, no students or teachers dey around. Dis strike come afta Naija Union of Teachers (NUT) for FCT talk say make […]

todayApril 20, 2026 13

National

Boko Haram Give 72-Hour Ultimatum Over 416 Captives

By: Esther Ayoola Every day with in own trouble, say Boko Haram terrorists don release video on Monday dey threaten Naija gornment over 416 pipo wey dem kidnap for Borno State. Dem say make gornment no try rescue di victims by force, say dem dey ready fight back if dem try am. Di group also give 72 hours warning say if dem no meet dia demands, dem go scatter di […]

todayApril 20, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds