News-auth

697 Results / Page 16 of 78

Background

Sports

Ukrainian Athlete Get Permission To Wear Black Armband For Olympics

By: Esther Ayoola For Milan Cortina Winter Olympics, Ukrainian skeleton racer Vladyslav Heraskevych don get di go ahead from Olympic Organisers to wear black armband to honor Ukrainian sports pipo wey Russia kill for war. IOC tuk, tuk, Mark Adams normally dis move dey against Olympic rules, tuking about political symbols, so dem bin ban am b4. Meanwhile, Ukrainian Presido, Volodymyr Zelensky support Heraskevych right to show respect to fallen […]

todayFebruary 10, 2026 4

Lagos

APC For Ikorodu Rally Support For Tinubu 2027

By: Esther Ayoola Chairmo of Di All Progressives Congress, Lagos branch, Cornelius Ojelabi, and Lagos East Senator, Tokunbo Abiru, don dey ginger boys for Ikorodu make dem gather support for baba Seyi for 2027 election. Dem yarn dis one during one ogbonge  stakeholders’ meeting for Ikorodu wey APC members put body for President Bola Tinubu for second term. Abiru tuk say di meeting na to unite party members and make […]

todayFebruary 10, 2026 9

Lagos

NAFDAC Burst Big Fake Drug Racket For Lagos

By: Esther Ayoola Operatives of National Agency for Food and Drug Administration and Control, NAFDAC don burst one serious fake drug racket for Lagos, seize over 10 million fake and banned medicine wey dem hide inside warehouse for Trade Fair–Navy area, Lagos. Director of Investigation and Enforcement for NAFDAC, Martins Iluyomade, say na sharp intelligence wey dem get afta training meeting on February 3, nai make dem uncover di place. […]

todayFebruary 10, 2026 7 4

Lagos

Makoko Residents Beg Gornment As Lagos Lawmakers Inspect Demolitions

By: Esther Ayoola On Monday for Makoko waterfront inside Lagos, residents and children cry out, dey beg, (say "Jọwọ") as members of Lagos State House of Assembly come visit di area to check ongoing evictions. Di lawmakers, wey come under House Committee on Rules and Business for fact-finding mission, hear from students of Makoko Students Association wey sing national anthem and tell gornment say “our community, na our home,” begging […]

todayFebruary 10, 2026 4 2

National

Osogbo Imam, Four Others Enter Court For Murder Case

By: Esther Ayoola Imam Abdulgafar Sakariyah, and four oda people don appear for Osogbo Chief Magistrates’ Court over how one worshipper, Ahmed Najeem, kpai during early morning prayers. Say dem jaguda boys beat Najeem afta e allegedly try to attack Imam for Ummu Haani Adigun Memorial Central Mosque on January 30. All of dem do face like stonecold as police arrest dem for di murder charge. Say aproko pipo now […]

todayFebruary 10, 2026 6

National

Oyo Princes Drag Alaafin Owoade Go Court

By: Esther Ayoola Say Alaafin of Oyo, Oba Akeem Owoade, don dey chest court wahala wey some Oyo princes file against am. Di princes, Ladigbolu Adegboyega, Owoade Tesleem, Adeyemi Adesina, and Adeyemi Adebayo, dey ask court make stop Oba from some function wey im nor suppose attend. Dem sti tell court make e no dey act like say e dey below any other Oba for Yorubaland. Dem say, Alaafin office […]

todayFebruary 10, 2026 2

National

Tinubu Boost Say Im Economy Reform Don Dey Show Beta Workings

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu tuk say di economic reforms wey im gornment bring don start to show beta result, as di country macro-economy dey stabilize small small and money wey federal dey share to states and local governments don increase. Im yarn dis one on Monday for Abuja, as e open di two-day National Economic Council conference. According to Di presido, sai Naija dey face plenty […]

todayFebruary 10, 2026 4

National

Appeal Court Back Senate, Say Suspension Of Natasha Dey Right

By: Esther Ayoola Court of Appeal for Abuja don tuk say Senate no do anything wrong when dem suspend Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey represent Kogi Central because of misconduct. Three judges wey sit for di case agree say her parliamentary privilege and constitutional rights nor spoil as Senate suspend am. But di court cancel di contempt case and di ₦5 million fine wey dem give her over di satirical apology […]

todayFebruary 10, 2026 3

National

Former Councillor For Benue Explain How Jaguda Boys Kidnap Worshippers For Church

By: Esther Ayoola Former councillor wey represent Ukwuenyo Ward for Ado Local Government, Emmanuel Udah, Benue state don Konfamate jaguda boys doings for im state, say dem con kidnap some pipo for church on Monday. Untop yarnings with tori pipo, e describe di mata as planned attack against di church, say dem carry innocent worshippers while dem dey pray and no get anything to defend demself. Udah say pipo for […]

todayFebruary 10, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app