News-auth

1021 Results / Page 17 of 114

Background

National

Plateau Gorment Put 48-Hour Curfew For Jos North Following Jaguda Boys Attack

By: Esther Ayoola Plateau State Gornment don impose 48-hour curfew for Jos North LGA afta Sunday attack for Angwan Rukuba wey kpai plenty pipo and wunjure odas. Commissioner for Information, Rt. Hon. Joyce Lohya Ramnap naim announce am, say di curfew start from yesterday midnight March 29 and e go reach April 1, 2026. For reaction, Governor Caleb Manasseh Mutfwang condemn di attack as “barbaric and unprovoked” and assure say […]

todayMarch 30, 2026 6

obodo oyinbo

Russia Kick UK Diplomat Say Im Dey Spy On Russia

By: Esther Ayoola Russia don order British diplomat Albertus Gerhardus Janse Van Rensburg to leave Moscow afta dem accuse am say e dey do spy work According to FSB security service report on Monday, di 29-year-old embassy secretary dey accused of “subversive intelligence activities wey fit threaten Russia security,”. Russian foreign ministry tuk say dem don call Britain charge d’affaires come warn dem wella dat if dem do dem wetin […]

todayMarch 30, 2026 5

Sports

Tristan Xerri Chop 3-Match Ban Afta E Rub Nose Blood For Oda Player Face

By: Esther Ayoola North Melbourne player Tristan Xerri don collect three-match ban afta e use im nose blood rub Andy McGrath face for match wey dem play on Saturday. Di incident hapun afta Xerri score goal, come get small fight with McGrath before e wipe di blood, something wey officials call “disgraceful behaviour.” For tribunal, Xerri tuk say dem insult am call am “weak c-word,” naim make e lose im […]

todayMarch 30, 2026 3

Sports

Spurs Set Eye For Roberto De Zerbi After Igor Tudor Sack

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don begin chase for Roberto De Zerbi to become dia new coach afta dem sack Igor Tudor. Tudor stay for only 44 days before bad results push di club close to relegation zone for Premier League. Reports say De Zerbi, wey don leave Olympique de Marseille since February, don show interest to take di job immediately. Inside Tottenham Hotspur camp now, dem believe say e […]

todayMarch 30, 2026 5

Sports

Quadri Aruna Get Tough Opponents For 2026 ITTF World Cup In Macao

By: Esther Ayoola Say Quadri Aruna gat play strong match and gat ready for 2026 ITTF World Cup wey go shelle for Macao, China from March 30 reach April 5. Dis year tournament get special meaning as International Table Tennis Federation dey celebrate 100 years, with 48 men and 48 women dey compete for Evans and Hammarlund Cups. Aruna sti be di only African wey don reach World Cup quarterfinal […]

todayMarch 30, 2026 10

Sports

Tottenham Hotspur Sack Igor Tudor Afta 7 Games

By: Esther Ayoola Tottenham Hotspur don comot dia coachie Igor Tudor afta di both of dem agree to terminate im contract Asap. Tudor manage dem only for seven matches, lose five, wey make Spurs dey struggle and just one point above relegation zone for Premier League. Dem also don drop out from Champions League race as results no dey favor dem at all. Club tuk say na mutual agreement, but […]

todayMarch 30, 2026 4

Sports

CAF Increase Africa Cup Of Nations To 28 Teams

By: Esther Ayoola CAF Presido, Patrice Motsepe, say like dis now, say dem wan increase di Africa Cup of Nations teams from 24 to 28 wey go dey play di AFCON. E tuk dis one for press conference on Sunday afta CAF executive committee meeting for Africa, say di change na to turn Africa football to  world-class football. Motsepe nor explain how di tournament go fit take di extra four […]

todayMarch 30, 2026 5

Sports

NPFL Match Day 32, Niger, Ikorodu, Bayelsa, Rivers Collobi Big Wins

By: Esther Ayoola Na correct football action happen for NPFL Match Day 32 on Sunday. Niger Tornadoes knack Wikki Tourists 2-0, while Ikorodu City shock Warri Wolves 4-3. Bayelsa United crush Kano Pillars 4-1, and Rivers United waka pass Kun Khalifat 4-2. Some games end draw, like El-Kanemi Warriors 1-1 Remo Stars, Barau FC 0-0 Katsina United, and Bendel Insurance 2-2 Plateau United.

todayMarch 30, 2026 5

Sports

Ikorodu City FC Survive Late Comback, Beat Warri Wolves 4–3

By: Esther Ayoola Ikorodu City FC collobi beta 4–3 winners against Warri Wolves FC for NPFL Match Day 32 putting pressure for di title race. Abayomi Ayodeji nah im open di scoring for 8th minute, Joseph Arumala add another, but Warri Wolves begin chase di game very early. Ikorodu City sti score own goal and Tosin Oyedokun make am 4–2 before Wolves finish with late goal for 94th minute. Coach […]

todayMarch 30, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app