News-auth

1164 Results / Page 18 of 130

Background

National

Vice Presido Shettima Put Bodi For Youth Dialogue, Call For Investment

Vice President tuk say Naija need serious plan to train young leaders, because na dem dey carry di future of di country. Di vice presido hammar dis mata for Abuja Dialogue 2026 for Abuja, say time don reach to stop tuking, telling leaders to show workings. Shettima make am clear say, if gorment nor invest on youth, say dem dey endanger di future of di kontri.

todayApril 14, 2026 12

National

Police Gbab 50 Suspects, Seize Heavy Weapons For Anti-Crime Operation

Naija Police don do Rambo style arrest about 50 suspects and recover plenty dangerous weapons for different operations wey dem carry out across di country. Police say dem do di arrests between January and April 2026 as dem dey push harder to stop serious crimes. Force PRO, DCP Anthony Okon Placid, yarn dis one for press briefing wey hapun for Guzape, Abuja. According to am, di operation target criminals wey […]

todayApril 14, 2026 13

National

Senator Ndume Beg Tinubu To Rescue Di Over 400 Villagers Wey Terrorist Carry

Senator Ali Ndume wey dey represent Borno South don beg oga Presido, Tinubu make e put more effort to rescue di over 400 pipo wey insurgents carry from Ngoshe community for Gwoza area last month. U sabi say di people wey di jaguda boys carry, na mostly women and children. Ndume tuk dis one for press briefing say e bad say gornment never sti bring back di victims, even afta […]

todayApril 14, 2026 14

National

Minister of Education Alausa Inaugurate Two Model Science Schools For Kogi

Education Minister, Dr Tunji Alausa, don open two model science secondary schools for Kogi State on Monday. He praise Governor Ahmed Usman Ododo for im strong effort to betalicious education. Di schools, GYB Model Science Secondary School for Nagazi and Okebukun for Kabba-Bunu. Alausa stress di federal gorment readiness to partner state gorment to make sure say dem bring beta education.

todayApril 14, 2026 12

National

Court Shift El-Rufai Bail Mata To April 14

By: Esther Ayoola Kaduna State High Court on Monday don adjourn di hearing of bail application wey former govo Nasir El-Rufai file, go April 14, 2026, as e show face for court under tight security for ICPC case. Dem dey accuse am and im co-defendant Amadu Sule for financial misconduct and abuse of office, but court later agree to remove Amadu Sule from di arraignment. El-Rufai plead not guilty to […]

todayApril 14, 2026 9

National

Adamawa ADC Suspend Atiku, Babachir Lawal, Others Say Dem Dey Cause Division

By: Esther Ayoola One faction chairmo for Adamawa state Africa democratic Congress, ADC, Raji Zumo, don announce say dem don suspend former Vice President Atiku Abubakar. Dem make di announcement for press conference wey hapun on Monday. Di ADC faction chairmo, also suspend former SGF Babachir Lawal and party transition committee chairmo, Sadiq Ibrahim. According to am, di reason be say dem dey cause division for di party.

todayApril 14, 2026 14

National

AGF Fagbemi Push For Community Justice, Say Time Don Reach For State Police

Naija Attorney-General and Minister of Justice, Lateef Fagbemi, don share update say di Naija security problems, only federal gorment nor go fit run am, say men need to put hand. Im yan dis one for di 2026 Law Week of di Nigerian Bar Association, Sokoto branch. According to am, many serious security problems dey start normally start from local level, family palava and resource control. E call for strong community […]

todayApril 13, 2026 18

Lagos

Lagos Police Clear False Alarm Say Area Dey Free From Cult Operations

Lagos State Police Command don clear air on di rumour wey fly say cultist wan test dia power for Shitta, Akerele, Itire/Aguda and Ishaga  area, say di report na false alarm. Dis one di police put for statement wey di police tuk tuk person, PRO Abimbola Adebisi release to tori pipo on Monday Say, CP Tijani Fatai don order heavy security presence, with plenty patrol and better monitoring for all […]

todayApril 13, 2026 18

National

How Gunmen Kpai Traditional Ruler, Burn Im Body And Others For Imo State

Say nor be small thin sup on Friday for Asa Awara Road near Ochia Autonomous Community, Imo State, dat unknown gunmen go kpai Eze Paulinus Ekwueme, di traditional ruler, im two brothers, driver and security aides as dem dey return from meeting. According to report, Di attackers open fire, kill dem, then burn dia bodies and di monarch official vehicle for road. Police tuk tuk, Okoye Henry naim explain dis […]

todayApril 13, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds