News-auth

332 Results / Page 21 of 37

Background

National

President Tinubu Leave Lagos Go Europe, Set For Abu Dhabi Summit

By: Esther Ayoola Afta joliment for Lagos, say wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don leave Lagos go Europe on Sunday, December 28, for im  end-of-year break and dat afta dat, im go enter area for United Arab Emirates for official trip. According to statement from President tuk tuk, Bayo Onanuga, say Tinubu go enter Europe flex small den, go later travel from Europe go Abu Dhabi to attend di […]

todayDecember 29, 2025 5

Lagos

Tinubu, Sanwo-Olu, Other Big Men Celebrate 73rd Eyo Festival For Lagos

By: Esther Ayoola Over di weekend, nor be small flex for wi oga Presido, Bola Tinubu, Imo State Governor Senator Hope Uzodimma and other big people joinbodi with Lagos State Governor Babajide Sanwo-Olu  flex, say dem dey celebrate di 73rd Eyo Festival for Lagos on Saturday. Di festival wey people dey call Adamu Orisa play, shelle  for Tafawa Balewa Square, if you see di agbada wey wi oga presido dek, […]

todayDecember 29, 2025 5

obodo oyinbo

Russia, US Tuk Peace But Embassy Palava Still Remain

By: Esther Ayoola Russia and America diplomats don meet to tuk about some wahala wey dey spoil dia relationship, but Russia say big big issues never settle yet. According to report, Dem tuk say di meeting na about embassy problem, and another round go happen early next year. Russia also tuk say dis discussion no get anything to do with di Ukraine war.

todayDecember 23, 2025 4

National

IGP Order Police Say Make Dem Guide Pipo For Di Christmas And New Year

By: Esther Ayoola Inspector-General of Police, Kayode Egbetokun, don order make police deploy plenty personnel and equipment across di country to ensure security for Christmas and New Year celebrations. Di directive tell all zonal AIGs and state commissioners to increase patrols, visibility policing, intelligence work and community engagement during di festive period. For di IGP, say security mat ana collabo with other security agency dey make work wella.

todayDecember 23, 2025 6

Sports

EPL: Liverpool’s Isak Do Surgery For Leg, Say Im Go Dey Out Months

By: Esther Ayoola Liverpool don share update dat dem don do surgery for Swedish striker Alexander Isak afta im wunjor im leg for Saturday match against Tottenham. According to report on Tuesday, say di Sweden striker leg dey broken, fibula scatter small, but surgery go well. Club never yarn how long e go take recover, but dem talk say Isak go dey sideline for at least  few months.

todayDecember 23, 2025 7

National

Lagos Unveil N800m LSSTF Headquaters For Ikeja

By: Esther Ayoola Lagos govo  Sanwo-olu don officially lunch di new Lagos State Security Trust Fund (LSSTF) HQ for Ikeja Central  Business District (CBD), to  boost security for Lagos big time. Say di project cost over #800 million and na big oga names like Kensington Adebukunola Adebutu go fund am, all to fund security for di state. Sanwo-olu tuk say di move na smart investment wey go protect lives, property, […]

todayDecember 23, 2025 7

National

NBA Wire Call To FG To Suspend Tax Reform Laws

By: Esther Ayoola The Nigerian Bar Association (NBA) bring mata out recharge 100 niara take make call to wi federal gorment say make dem suspend di Tax Reform Acts afta dem discover say some sections for di gazetted law no match wetin National Assembly pass. Di NBA tuk say dis kind matter dey spoil Naija law system name and dat dem need to investigate am wella. President of NBA, Afam […]

todayDecember 23, 2025 5

south west

Southwest States Join Hand Launch “Joint Show Of Force” To Tackle Highway Banditry

By: Esther Ayoola Oyo, Ogun and Lagos states don join hand launch joint security operation to stop banditry and wahala for highways and towns for southwest. Di operation, wey dem call “joint show of force,” dey target high-risk roads like Lagos–Ibadan expressway make commuters, residents and businesses safe, as police begin di exercise from Lagos side go Ojoo, Ibadan on Monday. CP Fatai Owoseni (RTD), special adviser to Governor Seyi […]

todayDecember 23, 2025 5

National

FG Make Pre-Employment Drug Test Mandatory For All Public Service Workers

By: Esther Ayoola Di federal government don approve say all prospective workers for Nigerian public service must do drug test before dem fit get job, di office of di secretary to di government of di federation (OSGF) announced in a service-wide circular dis week. According to director of information and public relations for OSGF,  Segun Imohiosen, di move na to curb rising drug abuse and protect national productivity and security. […]

todayDecember 23, 2025 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app