News-auth

1021 Results / Page 22 of 114

Background

obodo oyinbo

US Airstrike Kpai 15 Iraq PMF Fighters

By: Esther Ayoola US airstrike don go kpai 15 members of Iraq paramilitary group wey dem dey call Popular Mobilisation Forces, including one senior commander for Anbar area. PMF tuk say di attack na serious violation of Iraq sovereignty and e no show respect for di country at all. Dem also say di action no follow international law or humanitarian rules. Dem come beg Iraq political leaders make dem stand […]

todayMarch 24, 2026 9

National

Abubakar Malami Accuse EFCC Of Political Oppression

By: Esther Ayoola Former Attorney General Abubakar Malami on Monday for Abuja don accuse Economic and Financial Crimes Commission say dem dey use political intimidation afta dem raid im house. EFCC operatives say dem act based on court order wey grant interim forfeiture, and na why dem go mark di property. For one viral video wey surface same Monday, Malami question di officers and ask dem to show di legal […]

todayMarch 24, 2026 5

Sports

Fans Drag FIFA Go EU Court Over Crazy 2026 World Cup Ticket Price

By: Esther Ayoola Football Supporters Europe (FSE) and Euroconsumers don file case on Tuesday give European Commission against FIFA over high ticket price for 2026 World Cup. Dem tuk say ticket for di tournament wey go happen June 11 to July 19 for US, Canada and Mexico too cost, and accuse FIFA say dem dey use monopoly power control sales. FSE say FIFA impose unfair and confusing buying conditions for […]

todayMarch 24, 2026 5

National

El-Rufai Show For Kaduna Court Over Corruption Case

By: Esther Ayoola Former Kaduna State Governor, Nasir El-Rufai, don waka enter Federal High Court for Kaduna today to answer di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission. ICPC tuk say call am over alleged corruption and financial misconduct wey im do during im time for office as governor. Say, Heavy security for court and around Kaduna town as armed policemen dey control di entrance of di court, while […]

todayMarch 24, 2026 8

Lagos

UK Returnee Kpai For Lagos-Ibadan Expressway Askident

By: Esther Ayoola A woman wey just return from United Kingdom come attend wedding for Abeokuta don go kpai for road crash along Lagos-Ibadan Expressway. Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Corps tuk, tuk, Babatunde Akinbiyi ni confirm to tori pipo, say di askident hapun around 6 p.m. on Monday when di white Toyota Camry wey dem take dey travel jam one moving truck. Akinbiyi say di woman kpai on […]

todayMarch 24, 2026 5

National

NDDC Open Foreign Master’s Scholarship For Niger Delta Youths

By: Esther Ayoola Federal Gornment, through NDDC, don open application for foreign Master’s scholarship for 2026/2027 academic session. Dem announce am for one flyer wey dem post on dia X page on Monday. According to dem, application start March 23, 2026, and go close April 19, 2026. Dem say di programme go help young pipo from Niger Delta get beta training make dem fit compete well both for Naija and […]

todayMarch 24, 2026 5

National

Delta Police Deny Ozoro “Rape Festival” Claims, Promise Action

By: Esther Ayoola Delta State Police command, through dia tuk, tuk, SP Bright Edafe, don dismiss report say na rape festival ni sup for Ozoro wey go viral on X. Bright tuk dis tuk for tv sit down tuk on Monday say di festival na Ozoro Alue-Do Festival, di locals dey call am. Im sti tuk dat di  four girls wey dem interview so far, no wan don agree say […]

todayMarch 24, 2026 7

National

IGP Olatunji Disu Ginger New Senior Officers To Show Workings

By: Esther Ayoola Di Inspector General of Police, Olatunji Disu, yesterday don ginger Naija newly promoted senior officers to see am as opportunate to serve dia fathers land. E tell di Deputy Inspectors-General (DIGs), Assistant Inspectors-General (AIGs), and Commissioners of Police (CPs) say make dem no tolerate corruption, indiscipline, or slack. Disu give dis charge for Abuja as e dey decorate di officers with dia new ranks.

todayMarch 24, 2026 5

National

APC Declare Fintiri Di New Party Leader For Adamawa

By: Esther Ayoola Adamawa State Govo, Ahmadu Fintiri, don become di leader of APC for di state afta moving from di Pipos Democratic Party. Dem formally receive am for APC on Monday for Yola during one grand reception. Vice Presido Kashim Shettima, wey represent Presido, Bola Tinubu, explain every, every of di parti culture say Fintiri go automatically dey lead di party for di state.

todayMarch 24, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app