News-auth

1021 Results / Page 23 of 114

Background

National

Wike Ginger PDP Members To Rejection Election Failure

By: Esther Ayoola Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, like dis ginger members of Pipos Democratic Party wey wan contest 2027 elections make dem get confidence and no fear. Di FCT minister yarn dis one for Abuja during di party NEC meeting where dem make decision on di next party convention. Wike explain say di party convention go hold on March 29 and 30, 2026 for Abuja, and […]

todayMarch 24, 2026 5

Lagos

Ogun Police Touch Light Alleged Assault Of 8-Month-Old Pikin

By: Esther Ayoola Ogun State Police don start investigation say, one eight-month-old pikin suffer sexual assault for one private school for Ogun State. Di pikin mama, Gloria Umukoro ni carry di mata dey tuk, say di mata sup on Wednesday, March 18, for di same school wey she dey work. She explain say di pikin dey under di care of di school principal while she bin dey teach lesson for […]

todayMarch 24, 2026 6

Lagos

LSHD1 Launch Training To Stop Pregnant Women And Pikin Deaths

By: Esther Ayoola Lagos State Health District One (LSHD1) don start one ogbonge hospital programme on Monday for Orile Agege General Hospital to bring quick response for pregnant women, to reduce maternal and neonatal deaths. Permanent Secretary of LSHD one, Dr Sola Pitan, clear tori pipo say di programme go make PHCs and secondary hospitals dey work together and hellep health workers sabi danger signs early. According to W.H.O report, […]

todayMarch 24, 2026 6

Lagos

Lagos Taskforce Gbab Five “Omotaku” Wey Dey Extort Motorists

By: Esther Ayoola Lagos State Taskforce don arrest five street boys wey dem dey call “Omotaku” for Aboru–Abule-Egba area of Abeokuta Expressway on Monday. Di suspects, wey include Alade Olarewaju, Oluwadamilare Alabi, Sunday Idowu, Rabiu Ibrahim, and Raji Yusuf, say dem catch dem, afta one motorist call di Taskforce say dem wan extort am. Chairmo of di Taskforce, CSP Adetayo Akerele, yarn for statement say dem bin dey even track […]

todayMarch 24, 2026 6

Lagos

APC Govos Gather For Lagos To Plan Next Convention

By: Esther Ayoola Say nor be small tin, dat Govos wey dey under All Progressives Congress gather demselves for Lagos on Monday oh, to strengthen unity and plan ahead for coming political activities. Di meeting wey happen for Victoria Island, say na part of effort to align leadership and prepare di party wella for future elections. Untop yarnings with tori pipo afta di meeting, Chairmo of APC Govos family meeting, […]

todayMarch 24, 2026 7

Lagos

Dangote Explain How Global Oil Wahala Fit Make Life Hard For Africa

By: Esther Ayoola Oga Presido of Dangote Group, Aliko Dangote, say global oil wahala fit make life hard for Africa if world pipo nor settle di mata fast, fast. Senoir man Dangote tuk dis tuk for meeting with wi oga presido, Bola Tinubu on Monday. Dangote warn say if oil price sti climb, pipo go suffer oh, like barbers, bakers, and those wey dey run generator, and gornments nor go […]

todayMarch 24, 2026 5

Lagos

Lagos Govo Sanwo-Olu Sign Mou For Digital Learning

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say like dis now, dem don sign MoU with digital learning company, to bring digital learning to all gornment primary and secondary schools. Im yarn dis one for him verified X page on Monday. Say, di MoU go make sure say modern digital learning platforms and Korect infrastructure enter public schools. Sanwo-Olu sti tuk say, di partnership go hellep students sabi both […]

todayMarch 24, 2026 4

obodo oyinbo

Israel Attack Bridges, Enter Lebanon For Long Fight

By: Esther Ayoola Israel army commander Lieutenant General Eyal Zamir on Sunday for southern Lebanon announce say Israel don begin big ground operation against Hezbollah because dem wan stop di Iran‑backed group wey dey fire rockets and violate Israel borders. Oga Zamir say dem don destroy some bridges near di Litani River wey Israel claim Hezbollah dey use cross for attack, and dem plan to advance ground operations and air […]

todayMarch 23, 2026 5

National

IGP Olatunji Disu Make Move To Reduce Police Tactical Teams

By: Esther Ayoola Police oga for Naija, Olatunji Disu, on Sunday for Abuja don order make dem reduce tactical teams across di country. According to police tuk tuk, Anthony Placid, say di IGP say zonal and state commands no go get pass five teams, while area commands and divisions go get only three teams. Im explain say dis decision come based on di plenty tactical units wahala and dat some […]

todayMarch 23, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app