News-auth

1021 Results / Page 21 of 114

Background

Lagos

Lagos Gorment Launch Local Committees To Tackle Pikin Malnutrition

Lagos State Gorment don inaugurate local gorment and LCDA committees wey go handle food and nutrition, to tackle malnutrition for grassroots. Permanent Secretary for Ministry of Economic Planning and Budget (MEPB), Olayinka Ojo, ni tuk dis during a two-day inauguration wey hold for Ikeja. She yarn say malnutrition na serious problem for di obodo Naija. Say di gorment wan fight malnutrition by setting up dis committees wey go plan and […]

todayMarch 27, 2026 5

Lagos

Oga Govo, Sanwo-Olu Open Irele Towers As Lagos Free Trade Zone

Govo, Babajide Sanwo-Olu don open one new ogbonge free commercial building wey dem dey call Irele Towers for Lagos Free Trade Zone. For di ogbonge lunching on Thursday, baba govo say dis building go hellep boost Lagos economy, create jobs, and attract investors. Di govo thank private investors wey join hand to develop di project, explain say e go give businesses easy access to ports and other important infrastructure. Sanwo-Olu […]

todayMarch 27, 2026 4

Sports

FIFA Drop New Rules For 2026 World Cup

By: Esther Ayoola FIFA don announce new rules wey dem go use for 2026 World Cup for USA, Mexico, and Canada. Now, any player wey dem dey substitute get only 10 seconds to waka comot, or im team go play wit 10 players for one minute. Throw-ins and goal kicks get 5-second timer, and if dem delay, opposition go carry ball. Any player wey dey get medical attention must waka […]

todayMarch 27, 2026 5

Sports

D’Tigress To Jam Indiana Fever For Big USA Preseason Game May 2

By: Esther Ayoola Naija women basketball team, D’Tigress, don add one big game for dia USA tour as dem go play against Indiana Fever for preseason. Di game go hapun for May 2, 2026, for Gainbridge Fieldhouse, Indianapolis, as dem dey prepare for 2026 FIBA Women’s Basketball World Cup. Team Naija announce di new fixture for X, say dem don already get game for San Diego and Kansas City before […]

todayMarch 27, 2026 5

Sports

Senegal To Parade AFCON Trophy For Paris

By: Esther Ayoola Say like dis, Senegal dey plan show dia Africa Cup of Nations trophy before dia game wey dem go play against Peru for Paris on Saturday. Dis na according to head of Senegal Football Federation, Papa Amadou Diop. Nor be amebo say, Di Teranga lions win dia second Afcon trophy on 18 January afta dem beat Morocco 1-0 for Morocco, but di win, issue full am based […]

todayMarch 27, 2026 4

obodo oyinbo

Trump Hold Back Iran Attack Say Peace Tuk Dey Go Well

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump say like dis now, e go delay attack for Iran energy plant, by 10 days, reach April 6, and dat, di peace tuk dey go well. However, ogas for Iran dey yan newspipo say, US peace plan, dey one-sideded and e nor fair. Pakistan Foreign Minister Ishaq Dar say dem tanda for centre dey tuk to U.S. and Iran, to try stop di […]

todayMarch 27, 2026 7

obodo oyinbo

Iran Allow 10 Oil Tankers Pass Strait Of Hormuz

By: Esther Ayoola US Presido Donald Trump tuk on Thursday for Washington say Iran don allow 10 oil tankers pass Strait of Hormuz. Trump tuk for im truth social say dis na “gift” from Iran to show dia seriousness about negotiations to stop di war, wey don dey go on for nearly four weeks now. Di tankers, wey Trump say fit be Pakistani-flagged, travel di strait of Hormuz wey don […]

todayMarch 27, 2026 5

obodo oyinbo

UN Vote Say Slave Trade Na Biggest Crime In History

By: Esther Ayoola Yesterday for UN headquarters for New York, UN General Assembly vote say, transatlantic African slave trade na “di biggest crime against humanity.” Ghana propose di motion, and 123 countries gree to am. USA, Israel, and Argentina oppose di vote, while UK and all 27 EU countries watch hand comot. Untop yarnings with tori pipo afta di meeting,  Ghana Presido, John Mahama tell reporters say e dey support […]

todayMarch 27, 2026 6

Sports

Super Eagles Open Antalya Camp Today Ahead Friendly Vs Iran, Jordan

By: Esther Ayoola Say like dis di Super Eagles don open camp for Antalya, Turkey today, Tuesday, for dia international friendly matches against Iran and Jordan, According to dia media tuk, tuk, Promise Efoghe, Head coach Éric Chelle call 23 players to join di camp so dat dem fit prepare well for di games. Coaches and officials don already land Istanbul, Turkey, and di players go start enter later today. […]

todayMarch 24, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app