News-auth

322 Results / Page 24 of 36

Background

Lagos

Early Mormor Fire Scarra 48 Shops For Elegushi Market, Lekki

By: Esther Ayoola One early mormor fire don scatter Elegushi Model Market for Lekki area of Lagos State, say e burn wetin nor good from about 48 shops. Permanent Secretary of Lagos State Emergency Management Agency, Olufemi Oke-Osanyintolu, wey jump comot sleep go the area na dey confamate dis tori for statement on Sunday. E talk say dem receive emergency call around 2 a.m., and when dem reach the place, […]

todayDecember 15, 2025 12

National

President Tinubu Wire Call To West African Leaders To Join Bodi Fight Terrorism

By: Esther Ayoola President Bola Tinubu don  recharge 100 naira,  wire wire call  to West African leaders say make dem join hand fight terrorism and military takeovers for di region. As im dey vex, i nor fit tuk so, im carry the phone give im  vice, Kashim Shettima for di 68th ECOWAS summit wey sup for Abuja on Sunday. Tinubu yarn say no single country fit bring stability alone, and […]

todayDecember 15, 2025 8

National

FG Rake Full Newspaper Say Health Sector Standard For Di Obodo Nigeria

By: Esther Ayoola Wi Federal Gorment don bring mata dey rake full newspaper say Nigeria health sector dey stable for di last two and half years, and nothing serious don disturb am. Minister of Health, Ali Pate, yan this one on Sunday for TV sit down tuk, say na because di federal gorment give am beta attention and dem put money for di sector. Pate talk say, “For di last […]

todayDecember 15, 2025 6

National

PDP Back Governor Diri Say Make Dem Do Autopsy Test For Im Late Deputy

By: Esther Ayoola Bayelsa PDP don support Governor Douye Diri decision to carry out autopsy on him late deputy, Senator Lawrence Ewhrudjakpo, make dem sabi how im die. Governor Diri give the order on Saturday when former President Goodluck Jonathan come condole with am and Ewhrudjakpo family for Government House, Yenagoa. Diri talk say dem do am because social media dey spread fake rumor and talk about wetin kpai the […]

todayDecember 15, 2025 13

obodo oyinbo

Syria Security Man Go Kpai 3 Americans

By: Esther Ayoola Syria Interior Ministry don comot bodi from US wahala, gbebodia, yarn say, na one of dia security officer go kill two US soldiers and one civilian interpreter for Palmyra on Saturday. Di ministry talk for state TV on Sunday say, normally, dat particular officer get bad character and di man suppose comot from work because e get extremist Islamic belief. Washington sef confamate say, di jaguda boy […]

todayDecember 15, 2025 8

Sports

NFF Call For Sponsors To Bring Video Assistant Referee To NPFL

By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation (NFF) don clear mata say dem nor hapi with how referees dey do their work for Naija football leagues, after Nigerian refs miss chance to officiate 2025 Africa Cup of Nations (AFCON). NFF tuk this one after dem Executive Committee meeting wey hold for Abuja, dey call on senior mhen make dem con sponsor video assistant referee doings for the NPFL. Confederation of African […]

todayDecember 15, 2025 5

National

FG Recuit 94,000 New Security Officers To Rascal Jaguda Boys

By: Esther Ayoola Nor be small gbege say, boys dey hide for area as wi Federal Gorment 94,000 bring plan to recruit new security to battle insecurity. For inside statement on Thursday by di Head of Protocol and Public Affairs, Torty Kalu, dey confamate dis tory. Police Service Commission and Nigeria Police Force no even help mata at all, as dem declare say na about 50,000 new constables dem want […]

todayDecember 12, 2025 6

Lagos

FCCPC Seal Ikeja Electric Hq Over Consumer Palava

By: Esther Ayoola See Gobe, for Ikeja Electric as Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) seal dia Headquarters on Thursday say dem deprive a consumer im right. Head of tuk tuk, Kingsley Okotie, yarn tori pipo say, im company nor dey hide and dat dem dey cooperate with regulators to settle di matter. Dem dey run ground with all stakeholders make sure say every directive from FCCPC dem follow […]

todayDecember 12, 2025 9

obodo oyinbo

Britain Economy Fall Again, Labour Dey Press For Growth

By: Esther Ayoola Britain economy don shock again as official data show say e shrink 0.1% for October afta e already fall 0.1% for September. Di office for national statistics release di numbers on Friday, and e dey dash blow to labour government wey dey hope revive economic growth. Analysts bin dey expect say economy go grow 0.1%, but di reality na contraction continue. Di only bright side be say […]

todayDecember 12, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app