News-auth

1027 Results / Page 34 of 115

Background

Sports

Moffi Score, Sanusi Give Assist As FC Porto Beat Stuttgart 2-1

By: Esther Ayoola Terem Moffi score one goal and Zaidu Sanusi give assist as FC Porto beat Stuttgart 2-1 away for dia UEFA Europa League Round of 16 first leg game for Germany on Thursday. Moffi start di game but comot for 59th minute, while Sanusi play full 90 minutes. Moffi open scoring for di 21st minute, and later Sanusi set up Rodrigo Mora to make am 2-0. Stuttgart reduce […]

todayMarch 13, 2026 3

Sports

D’Tigress Lose 77-60 To South Korea For FIBA World Cup Qualifier

By: Esther Ayoola Naija’s D’Tigress don lose to South Korea 77-60 for dia second game for di qualifying tournament for di 2026 FIBA Women’s World Cup. Di last time D’Tigress lose na for quarter-final against United States for di Paris 2024 Olympics. Dem enter South Korea game on Thursday afta dem knack Colombia for dia first match for Wednesday. For di first quarter, South Korea  lead 20-16, and even though […]

todayMarch 13, 2026 12

National

Akpabio, Ooni, Olu of Warri, Others Salute Tinubu Say Im Try For Di Ambassador Selection

By: Esther Ayoola Senate Presido, Godswill Akpabio, Ogun State Governor Dapo Abiodun, Ooni of Ife Oba Adeyeye Ogunwusi, and Olu of Warri Ogiame Atuwatse III don hail oga Presido, Bola Tinubu for appointing Senator Jimoh Ibrahim as Naija UN envoy. Dem say di appointment na smart move wey go boost Naija diplomatic doings for international level. Ooni of Ife say, Ibrahim education and experience make am di right person to […]

todayMarch 10, 2026 12

National

Dangote Refinery Promise Steady Fuel Supply Despite Global Oil Crisis

By: Esther Ayoola Dangote Refinery Managing Director, David Bird, say Naija go sti dey get steady fuel supply even as global crude oil price dey  hike, like say tomorrow nor dey. Brent crude oil don nearly reach $120 per barrel based on di wahala for Middle East and plenty geopolitical tension. Addressing dis mata for press, on Monday, Bird say Dangote go make sure say, di product nor finish even […]

todayMarch 10, 2026 6

National

ADC Call For Arrest Of Ikwerre Chairmo Say Jaguda Attack On Amaechi Convoy

By: Esther Ayoola Say nor be small gbege for Rivers state, wia African Democratic Congress don call for di arrest and investigation of  oga Chairmo of Ikwerre LGA, Wobodo over alleged attack on di convoy of former govo, Rotimi Amaechi. Nor be amebo say on Friday, March 6, 2026, for di Omuanwa axis, as Amaechi dey travel go him hometown Ubima for party registration say some jaguda boys attack am. […]

todayMarch 10, 2026 6

National

PDP Turaki Group Reject Appeal Court Judgement

By: Esther Ayoola Di National Working Committee (NWC) of Pipos Democratic Party led by Kabiru Turaki don reject di judgement wey Court of Appeal give to cancel di party national convention wey hapun for Ibadan on November 15 and 16, 2025. Tuk, tuk of di Turaki faction, Ini Ememobong, ni put dis one for statement, say dem don tell dia lawyers make dem carry di mata go Supreme Court of […]

todayMarch 10, 2026 3

National

Zamfara Governor Dauda Lawal Dump PDP Join APC

By: Esther Ayoola Zamfara State Governor, Dauda Lawal, don leave Pipos Democratic Party (PDP) join All Progressives Congress (APC). For statement on Monday, im media aide, Nuhu Anka, say di decision follow plenty consultations wit stakeholders, elders, and supporters for di state. DI statement put, say di wahala wey dey inside PDP fit affect governance and progress for Zamfara. E add say joining APC go give better unity, stability, and […]

todayMarch 10, 2026 3

obodo oyinbo

Middle East Wahala Hit Europe, Oil, Gas Prices Skyrocket

By: Esther Ayoola Say di war for Middle East don dey affect Europe, EU chief Ursula von der Leyen tuk on Monday. Oil price don reach almost $120 per barrel as US and Israel dey fight Iran, wey dey strike back for Gulf. Iran drone don hit British base for Cyprus, gas price jump, and people dey move because of di war. However Von der Leyen say, No need for […]

todayMarch 10, 2026 5

obodo oyinbo

Trump Warn Say E Go Hit Iran 20x Harder If Dem Try Am Stop Oil Flow

By: Esther Ayoola U.S. Presido, Donald Trump don promise to hit Iran “twenty times harder” if dem block oil tankers for Strait of Hormuz. and say di war go end “very soon.” Meanwhile Plenty pipo gather for Iran dey show support for new Supreme Leader Mojtaba Khamenei, say na im go decide wen di war go end, not be US. Iran sti dey fire back  Israel and US properties for […]

todayMarch 10, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app