News-auth

1027 Results / Page 35 of 115

Background

obodo oyinbo

G7 Countries Meet To Tuk How To Ensure Say Oil Keep Flowing

By: Esther Ayoola G7 countries tuk say dem ready take “necessary measures” to support global energy supply afta US-Israel war with Iran make oil price jump. G7 finance ministers and International Energy Agency (IEA) meet, but dem no agree to release oil from strategic stockpiles. Nor be amebo say, Oil price don nearly reach $120 per barrel on Monday, but e fall sharply afta Trump tuk say di war fit […]

todayMarch 10, 2026 5

Sports

Naija Football Legend, Chief Festus Onigbinde, Kpai At Age 88

By: Esther Ayoola Say Naija don lose one of dia big football oga, Chief Festus Onigbinde, wey be di first Nigerian  indigenous coachie for  di Super Eagles. Di family announced im passing in a statement signed by im Grand pikin, Bolade Adesuyi on Monday. According to report, di senior man kpai on Monday, and e bin dey 88 years old. Di family wey konfamate im passing, say Festus na Korrect […]

todayMarch 10, 2026 5

Sports

FA Cup Quarter-Final, Man City To Face Liverpool, Port Vale Go Play Chelsea

By: Esther Ayoola England don finish quarter finals draws for FA cup, dat Manchester City go jam Liverpool for FA Cup quarter-finals. According to BBC Sport, Port Vale, wey dey League One, go travel go Chelsea afta dem comot Sunderland. Arsenal go waka go Southampton, wey dey Championship, while Leeds go face West Ham. All di matches, dem go play am for April.

todayMarch 10, 2026 3

Sports

NFF To Fine Clubs Wey Go Dodge President Federal Cup

By: Esther Ayoola Di Naija Football Federation (NFF) don declare say any club wey no show for dis year President Federation Cup State preliminaries go pay N500,000 fine. NFF’s Director of Competitions, Ruth David, ni dey put dis one for statement on Monday. Say, State preliminaries go start on Sunday, 22nd March, come run till 26th April. Final match for State level go hapun either Saturday 25th April or Sunday […]

todayMarch 10, 2026 5

Sports

How Ref Take Serve 23 Players Red Card For Brazilian Finals

By: Esther Ayoola Wahala dem say nor dey finish, say nor be small fight burst for Brazil during Campeonato Mineiro final between Cruzeiro and Atlético Mineiro after Cruzeiro manage win di match 1–0. Di trouble start for deep stoppage time when Atlético goalkeeper Everson rugby-tackle Cruzeiro midfielder Christian after dem clash as di keeper drop di ball. Everson even kneel for Christian face and shout for am, and na dat […]

todayMarch 9, 2026 18

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Beg Authorities Make Peace Return To Iran

By: Esther Ayoola Pope Leo di fourteen XIV say, worry dey wound am wetin nor good,  as di  war for Iran dey  spread enter oda countries for di Middle East. E tuk say di fight wey don reach nine days since US and Israel attack Iran dey bring hate to di region. Oga Pope dey beg authorities, make dem stop di fight quick and start tuk for peace.

todayMarch 9, 2026 5

Lagos

Lagos Fix Streetlights For Night Movement

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, say like dis Lagos state gorment do dey install new streetlights and fix broken ones for major roads and highways to make security stand fit for beta night movement E put dis one for im Facebook page, say the work na part of the Light-Up Lagos project wey dey in progress. Di Government teams don do installation for different areas for both […]

todayMarch 9, 2026 5

National

Appeal Court Back Federal High Court, Stop INEC From Accepting PDP Ibadan Convention

By: Esther Ayoola Court of Appeal for Abuja don confirm di judgment wey Federal High Court give, wey stop Independent National Electoral Commission (INEC) from recognizing di result of Pipos Democratic Party (PDP) national convention wey happen for Ibadan from Nov. 15 to Nov. 16, 2025. Di appellate court three-member panel tuk say di appeal wey PDP file no get merit at all. Dem say di Federal High Court judge, […]

todayMarch 9, 2026 6

Sports

PSG Coach Luis Enrique Worry Bodi For Team Struggle

By: Esther Ayoola Paris Saint-Germain manager, Luis Enrique, throw lamentation say im team PSG dey struggle wetin nor good dis season. Dem lose 3-1 for house against Monaco and Enrique say, dem too dey make plenty mistakes. E say dem need find confidence quick oh, before Champions League match wey dem get against Chelsea, make Chelsea nor go use dia eyes see shege.

todayMarch 9, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app