News-auth

697 Results / Page 35 of 78

Background

Sports

Manchester United Eye Ndidi Move As Dem Chase Champions League

By: Esther Ayoola Unto football transfer updates, say Manchester United don revive interest for Super Eagles midfielder Wilfred Ndidi, wey now be captain for Besiktas for Turkey. According to transfer expert on Wednesday, di Red Devils dey find short-term midfielder to strengthen dia squad as dem chase Champions League qualification next season. Report tuk say United recruitment team don discuss possibility to bring Ndidi on loan.

todayJanuary 21, 2026 6

obodo oyinbo

Trump Hail US Economy for Davos, Throw Shade Give Europe

By: Esther Ayoola U.S Presido Donald Trump dis Wednesday afternoon,  don go whine world leaders wetin nor good for davos say  America “ na di economic engine of the world,”. Trump clear di world leaders  say America dey show workings yangayanga, whether na  inflation, dem dey top, investment nkor, say dem don reach trillions of dollars, say America don grow pass di prediction of internation monetary fund IMF. Oga dey […]

todayJanuary 21, 2026 5

National

Northern CAN Raise Security Concern Afta Kaduna Kidnap Denial

By: Esther Ayoola Oga  Chairmo of Christian Association of Nigeria (CAN),   northern branch, Joseph Hayab, don cut rope chain for security agencies for “denying”  jaguda boys kidnap pipo for Kaduna. Hayab yarn dis on Wednesday, hours afta Nigeria Police Force deny report say jaguda boys kidnap worshippers for Kurmin Wali community, Kajuru LGA, Kaduna. He tuk say how police and other security agencies just dey deny, dat all dis kin […]

todayJanuary 21, 2026 5

National

Court Sack Abure, Order INEC To Recognize Nenadi Usman

By: Esther Ayoola Federal High Court don go settle labour party leadership wahala, for Abuja on Wednesday,  dem rule say, Julius Abure, no longer bi  di  national chairmo of Labour Party say im tenure don expire. Na Human rights lawyer, Inibehe Effiong, na im yarn di mata for X, say im dey court when di judgment come out and say di decision follow earlier Supreme Court ruling. According to report, […]

todayJanuary 21, 2026 7

Lagos

Fashola Ginger Oga Presido To Update Naija New Ambassadors

By: Esther Ayoola Former Lagos State Govo, Babatunde Fashola, don wire wi oga presido Bola Tinubu message, say make im all new Nigerian ambassadors, especially non-career ones, sabi Nigeria policies, economic plans, and investment frameworks, Asap, before dem start work. Fashola yarn dis during him keynote speech for Nigeria Reputation Summit 2026 wey di Nigerian Institute of Public Relations hold for Abuja. E say di Senate don confirm 62 ambassadorial […]

todayJanuary 21, 2026 4

Lagos

Lagos Gorment Teach Civil Servants About Pension

By: Esther Ayoola Di Lagos State Head of Service, Bode Agoro, don ask public servants make dem start to learn about pension, say e dey improtakpa to avoid confusion later once dem retire. Agoro tuk dis tuk on Tuesday during Pension Awareness Programme wey Lagos State Pension Commission organize for Public Service Office, Alausa, Ikeja. E  say di programme na serious move to make sure workers  for di state wey […]

todayJanuary 21, 2026 5

Lagos

Lagos Gorment Set Tools For Lekki-Epe Expressway Construction

By: Esther Ayoola Lagos state gornment don konfamate say dem wan resume work for di 2 and 3 sessions of Lekki-Epe Expressway (from Ajah Bridge to Admiralty) on Sunday, January 25, 2026. Special Adviser to di Lagos State Governor on Infrastructure, Olufemi Daramola, na dey conversate dis update to tori pipo say,  di contractor don  already arrange im tools for ground afta smalle delay for Christmas, new year period. Say […]

todayJanuary 21, 2026 6

Sports

Naija Para Athletes Complain Over Allowance Delay

By: Esther Ayoola Na Naija para-athletes wey represent di country for di maiden West Africa Zone A and B Para Games wey hold for Abeokuta, Ogun State, from November 28 to December 4, 2025, dey complain say dem never still collect dia competition allowance, some tuk. One of di athletes, Chidera Okoro, ni dey touchlight dis mata give tori pipo, say dem never even see dia transport allowance for di […]

todayJanuary 21, 2026 9

Sports

Court Push Trial Of Driver Wey Kill Anthony Joshua Padi Friends

By: Esther Ayoola Di trial of Adeniyi Kayode, 46-year-old driver wey dey involved for di accident wey kill Anthony Joshua friends, Latif Ayodele and Sina Ghami, say court don carry im case go February 25, 2026. Di case wey suppose hapun for Sagamu Magistrate Court no fit continue because prosecution only get three of four witnesses. Prosecuting lawyer tuk say dem need more time to copy di case file give […]

todayJanuary 21, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app