News-auth

318 Results / Page 35 of 36

Background

Lagos

Man Don Jailed 21 Months For Stealing N50 Million Under Fake Pretence

By: Esther Ayoola For stealing and collecting money under false pretence, Justice Rahman Oshodi of Lagos Special Offences Court for Ikeja don find Chukwudole Chinedu guilty and sentence am to 21 months plus 18 days. EFCC charge am say e collect N50 million from Ezeh Paul Chukwudi, dey tell am say e get $70,000 to sell at N720, wey no true. Chinedu bin face two counts wey concern obtaining money […]

todayDecember 2, 2025 5

Lagos

Six Lagos Real Estate Marketers Don Kidnapped For Ogun State

By: Esther Ayoola Some jaguda boys again don gbab six real estate marketers for Lagos, while dem dey go inspect their company land for Oyebola village, Obafemi-Owode Local Government Area, Ogun State. Tori people carry say the victims waka go the land for inspection before the attackers strike. Police Commissioner, Lanre Ogunlow sef, don confirmate the development give news wakawaka that the incident happen on Friday.  And that like this […]

todayDecember 2, 2025 5

National

Oluremi Tinubu Don Share 10,000 Sanitary Pads Give Jigawa School Girls

By: Esther Ayoola Oga presido wife, Lolo Oluremi Tinubu, don share 10,000 sanitary pads give girl students for Jigawa State. Di gesture come at di time wey stakeholders and UNICEF dey shout make girls take care of themselves during menstruation. According to aproko, this move dey twin with Jigawa State Government ongoing support for women health, as dem dey join hand fight poverty for di region. As she dey talk […]

todayDecember 2, 2025 4

National

Tinubu Aide Abubakar Resigns on Health Grounds, President Accepts Letter

By: Esther Ayoola Minister of Defence, Mohammed Badaru, don resign from him post with immediate effect, say e no do again and that him no dey feel fine. E write letter give President Tinubu wey carry the resignation and e date am December 1. Special Adviser to the President on Information and Strategy, Bayo Onanuga, yan this one to TV sidon talk on Monday. Presidential spokesman talk say Abubakar resign […]

todayDecember 2, 2025 6

Entertainment

Kaka Igbokwe Confirms 2Baba’s London Arrest After Airport Clash With Wife

By: Esther Ayoola Former manager of music icon, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba and pikin of late legend Christy Essien-Igbokwe,, Kaka Igbokwe, don confirmate say di old trending video of 2Baba arrest for London after him quarrel with him pregnant wife, Natasha Osawaru, na true. Recall, 2Baba travel go United Kingdom with him pregnant wife for concert tour, but him no show for di October 2, 2025 performance […]

todayDecember 2, 2025 15

Entertainment

Reality TV Star Don Reveal How She Take Create Her Stage Name

By: Esther Ayoola Reality TV star and actress Roseline Afije, wey people sabi as Liquorose, don explain how she take get her unique stage name, and she talk say na her love for sapele water join with her real name inspire am. For one podcast wey she do with VJ Adams, Liquorose yarn say she choose the name back for December 2012, and since then e don turn her identity […]

todayDecember 2, 2025 11

National

Oluremi Tinubu Don Call Nigerians Make Dem Renew Fight To End Hiv/Aids By 2030

Wi Oga presido wife Senator Oluremi Tinubu, don call Nigerians make dem renew their commitment to end HIV/AIDS by 2030. She talk this one for statement wey she post for her X handle to mark World AIDS Day 2025 with the theme “Overcoming Disruptions; Transforming the AIDS Response.” According to her, the day remind everybody say make we ginger our efforts to finish HIV/AIDS once and for all. She still […]

todayDecember 1, 2025 5

Lagos

Lagos Dey Upgrade Waterfronts For Detty December – Alebiosu Talk

Di Lagos State Gorment don come with anoda mata say residents and holiday visitors go enjoy modernised waterfronts dis Detty December, as new reforms don land to boost di state tourism. Di Commissioner for Waterfront Infrastructure Development, Dayo Alebiosu, tok dis one for statement wey dem issue on Sunday after di Lagos Tourism and Hospitality Stakeholders’ Summit wey Ministry of Tourism, Arts and Culture host. He add say di state […]

todayDecember 1, 2025 3

Lagos

Rice Sellers Don Predict That Price Go Fit Drop Ahead Christmas

Some Senior   farmers for the ogbonge  Farmers Association of Nigeria (AFAN) ,  don cut cap for lagos govo, Babajide Sanwo-Olu  say im ma do well as him take slash Lagos rice from N64,000 to N57,000 per bag, Na on top tok tok with stori pipo for the state capital, Di Vice Chairmo of AFAN Southwest and Lagos chapter,  Sakin Agbayewa,  hail di move, say e go create competition and make […]

todayDecember 1, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app