News-auth

697 Results / Page 37 of 78

Background

Lagos

Fire Destroy Building for Computer Village, Ikeja

By: Esther Ayoola Another fire badness don sup again, say One-storey building, wia pipo dey do business ni burn wetin nor good for Computer village Ikaja on Tuesday for Somoye Osundairo Street. Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) sha reach area, explain to tori pipo dat di mata sup around 1:55 a.m. and as dem receive calls na so dem park dia tools, enter area for for rescue According to […]

todayJanuary 20, 2026 16 18

Lagos

One Person Kpai For Bus Askident Ikorodu

By: Esther Ayoola Say, another askident badness hapun for Ikorodu wia busus jam jam demselves igboa On Tuesday For Independence Tunnel Inward Maryland Along Ikorodu Road. Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) Report Say Di Askident serious say one person kpai for di mata. According to di LASTMA, dem don tow di motors, while dia Rescue And Recovery Team Dey Manage Traffic And Remove Di scata scata from ground. Di […]

todayJanuary 20, 2026 8

National

Kano Governor Abba Yusuf Enter Meeting With Oga Presido, Tinubu

By: Esther Ayoola Kano State Govo, Abba Yusuf, don go put bodi for meeting with President Bola Tinubu for Aso Rock, tuk plenty, even though say, wetin dem tuk, dem never share for public. According to report, di govo enter di President office around 4:13 in di afternoon and comot about three hours later, but e no tuk anything to Aproko pipo wey dey gate. But from di little informate […]

todayJanuary 20, 2026 9

National

DSS Pick Former AGF Abubakar Malami Afta Release

By: Esther Ayoola Former Attorney General of di Federation and Minister of Justice, Abubakar Malami (SAN), don land again for security wahala dis week, just moments afta dem release am from Kuje Correctional Centre for Abuja. As Malami comot from di correctional centre, operatives of di Department of State Services, DSS, sharp-sharp pick am up and carry am enter dia vehicle. Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, don clear […]

todayJanuary 20, 2026 4

National

Army Chief Charges 3 Division Soldiers To Bring Peace For Plateau

By: Esther Ayoola Army Chief, Lieutenant General Wahid Shaibu, don tell soldiers for 3 Division say make dem maintain discipline, professionalism, and dey committed as dem dey work to bring peace for Plateau State. Shaibu deliver dis tuk when e visit di Division headquarters for Jos, meet senior officers, commission new offices and soldiers’ quarters, and address troops for parade ground. E say, di military work for Plateau na serious […]

todayJanuary 20, 2026 3

obodo oyinbo

Beijing Ginjer Afghanistan To Protect Chinese Citizens After Kabul Bomb Blast

By: Esther Ayoola China don send SMS on Tuesday to Afghanistan say, make dem protect Chinese citizens afta bomb blast for Chinese Noodle restaurant for central Kabul, kill seven people. China say dem nor wan hear anytin, protect Chinese citizens ni be di message China Foreign Ministry tuk tuk, Guo Jiakun, tuk say dem don call di Afghan gornment make dem treat dose wey wunjor well and tighten security for […]

todayJanuary 20, 2026 21 16

Sports

Australia Open: Casper Ruud Fit Quit Tournament If Wife Go Into Labour

By: Esther Ayoola Norway tennis star Casper Ruud don tuk, say e fit leave di Australian Open anytime if im wife, Maria, go into labour. Maria dey heavily pregnant with dia first pikin, one baby girl, and Ruud say family come before tennis. Di 12th seed beat Italy player Mattia Bellucci 6-1, 6-2, 6-4 for first round match for Melbourne on Monday. Ruud say im, phone dey on every time, […]

todayJanuary 20, 2026 20

Sports

Naija Eagles Make Big Jump for FIFA Ranking Afta AFCON Bronze

By: Esther Ayoola Naija Super Eagles don jump enter 26th for di latest FIFA world ranking, na dia highest position for 16 years afta strong showing for 2025 AFCON for Morocco. Dem win six matches, lose one, and carry bronze medal come back afta beating Egypt 4–2 for penalties. Morocco, wey host di tournament, waka enter top 10 for first time since 1998, even though dem lose di final to […]

todayJanuary 20, 2026 6

obodo oyinbo

President Trump Invite Putin To Join Im ‘Board of Peace’ Movement

By: Esther Ayoola Oooh, US presido, Donald Trump dey find trouble sha, say im don invite Russian Presido Vladimir Putin make e join im “board of peace” wey go try solve all di shootie shootie wey dey go on for di world and hellep manage Gaza war. Dis invitation sef dey come, when Russia sti dey war with Ukraine, di mata sef don tey, nearly four years. Trump dey try […]

todayJanuary 20, 2026 13 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app