News-auth

1027 Results / Page 45 of 115

Background

Lagos

Lagos Deputy Govo Hamzat Tell Muslims To Celebrate Ramadan With Kindness

By: Esther Ayoola Lagos State deputy govo, Obafemi Hamzat, don advise Muslims and Christians make dem use Ramadan period show empathy, kindness, and good neighbourliness. Im tuk dis one for Ramadan prayer wey United Muslim Council of Naija, Mushin branch, arrange for Ogba, Lagos. Hamzat yarn say Ramadan fit hellep Nigerians understand each other wella and make dem become responsible citizens. E sti remind pipo say true religion go only […]

todayFebruary 23, 2026 4

Lagos

Obasanjo Plan Free Medical Outreach For Lagos Mark 89th Birthday

By: Esther Ayoola Former Presido Olusegun Obasanjo don plan free medical outreach wey go hellep over 10,000 pipo for Lagos to mark im 89th birthday. Baba Special Assistant, Media tuk, tuk, Kehinde Akinyemi, na im put dis one for statement on Sunday for Abeokuta. According to di OBJ Foundation Chief, Dr Olalekan Makinde, di Lagos Medical Mission go touch Ikorodu and Alimosho Local Government areas of di state from Feb. […]

todayFebruary 23, 2026 8

Sports

Kamaru Usman Drop Retirement Plan

By: Esther Ayoola Kamaru Usman don make am clear say e go only retire only afta e win both welterweight and middleweight UFC titles. Aproko pipo bin tuk say Kamaru don near retirement afta e loss to Leon Edwards and Khamzat Chimaev, but Usman shock everybody afta beating  Joaquin Buckley. U sabi say, Na im dey chase senior fighters like Conor McGregor and Amanda Nunes untop di wining of belts. […]

todayFebruary 20, 2026 17

Sports

President Tinubu meet Sports Commission Oga, Promise More Support for 2026

By: Esther Ayoola Chairmo of National Sports Commission, Shehu Dikko, on Thursday don go visit oga Presido Bola Tinubu for Presidential Villa for Abuja to clear am how sport perform for 2025 and plan for 2026. Afta di meeting, Dikko tell State House tori pipo say di visit na normal routine, because na direct to di  President, di commission dey report. According to am, baba seyi promise to continue supporting […]

todayFebruary 20, 2026 19

obodo oyinbo

King Charles III Show Face For London Fashion Week

By: Esther Ayoola King Charles III don go scarra ground, show face for London Fashion Week on Thursday, just hours afta police arrest  im brother, Prince Andrew. Di king waka enter di show for British-Nigerian designer, Tolu Coker, say, normally im suppose dey with im brother but di Kind, show face for fashion parade. Pipo even  ask am about Andrew, but e nor allow dat one distract am. Charles siddon […]

todayFebruary 20, 2026 12

obodo oyinbo

Iran Promise To Return U.S Energy Afta War Threat

By: Esther Ayoola Iran U.N. envoy tuk say, if US make war move, Iran go respond sharp-sharp. Iran dey ask U.N. Security Council senior man, Antonio Guterres, say make dem address Donald Trump threat. Nor be amebo again say, Trump bin say im fit use airfield for Chagos Islands to attack Iran. Iran say dem no wan start war, but if dem attack, all US base for dia region, ni […]

todayFebruary 20, 2026 10 5

National

ICPC Raid Abuja House Of Former Kaduna Gov El-Rufai

By: Esther Ayoola Di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) don go break enter di Abuja house of former Kaduna State govo, Nasir El-Rufai, like jet li, to search for possible corruption-related evidence. El-Rufai media adviser, Muyiwa Adekeye, ni dey konfamte dis mata give tori pipo on Thursday. According Adekeye, dem waka enter the house around 2pm and start dey search every corner of di property. El-Rufai […]

todayFebruary 20, 2026 8

National

CDS make Rambo Move to Flush Out Terrorists and Kidnappers

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, General Olufemi Oluyede don launch new military operation wey dem call Operation SAVANNAH SHIELD for Ilorin, Kwara State. Di ceremony hapun for 22 Brigade, Sobi Military Cantonment, and dem say di mission na to fight terrorists, kidnappers and other criminal gangs for North Central region. For di flag-off, di CDS say dis one no be ordinary deployment, dat na Rambo movement to flush […]

todayFebruary 20, 2026 8

National

Olawale Edun Explain Wia FG Keep Naija N58.472 Trillion 2026 Budget

By: Esther Ayoola Minister of Finance, Olawale Edun, don clear air say Naija N58.472 trillion 2026 budget dey safe based on di size, dat e dey fridge dey cool. Edun yarn dis one when im lead him economic team go defend di budget for Senate Appropriations Committee. Di committee members, wey Solomon Olamilekan Adeola dey lead, ask plenty questions and di team answer one by one.

todayFebruary 20, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app