News-auth

697 Results / Page 69 of 78

Background

National

Vice Presido Shettima Clear Tinubu Security Doings

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido Kashim Shettima don align marras say, president Bola Tinubu nor dey security matter play at all at all. Oga vice dey yan dis one for inside  NISS 18th executive intelligence management course crew for him office for abuja. Say, na about 78 guys including  commandant joseph odama, ni come  drop their final course report for VP. Shettima carry the report, yan say government dey […]

todayDecember 10, 2025 19 1

Lagos

Three Die As Three Motor Jam Demselves For Lagos-Ibadan Expressway

By: Esther Ayoola Wahala nor dey finish, say another one don burst for Lagos Ibadan express way  wia three motor jam demselves, three people  kpai on the spot  and plenty others dey hospital dey take treatment. Lagos state traffic management authority (LASTMA) confamate give tori pipo say the accident spoil things for the area. The koko happen near secretariat, as people dey waka go Otedola bridge, traffic jam choke everywhere. […]

todayDecember 10, 2025 6

National

Senate Raise Alarm Say WAEC Wan Stress SS3 Students

By: Esther Ayoola Nor be small gbege for  di Nigerian Senate, say Naija education  dey dey shakibalabala based on WAEC sudden change of  curriculum and  dat, SS3 students wey  go register for the exam go  write subjects wey dem never even see. Na so Lawmakers fire the mata on Tuesday yarn say dem go call Education Minister plus all top heads make dem explain why dem di ss 3 chidrensis  […]

todayDecember 10, 2025 11

Niger Delta

Obi: Naija No Suppose Dey Poor, God Already Bless Us

By: Esther Ayoola Presidential candidate of Labour Paty and before before Anambra state govo, Peter Obi, don tuk say Naija no suppose dey poor, no be poverty capital of world, because God don bless us with plenty resources  wey dey under our foot and wey dey for sky. E yarn this mata for one book launch for inside Abuja wey dey talk about the ogoni experience and how di people […]

todayDecember 9, 2025 9

National

President Tinubu Clear Nigerian Aprokos To Stop Fake News

By: Esther Ayoola Wi oga presido, Bola Tinubu, unto doings don  tell Nigerians make dem try to dey talk truth all the time  and stop to spread fake news. He talk this through  information Minister Mohammed Idris  during the launch of the “my nigeria, my responsibility” program for inside the obodo Nigeria. Idris  say,  Nigerians must promote correct information and show the world the countri progress, peace, and national values.

todayDecember 9, 2025 9

National

Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years

By: Esther Ayoola For Abuja,  after all the drama for Osun state between the dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu,  madam first lady don wire birth messgae give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statement  wey dem wrap like moimoi  drop for her x page, mama Remi hail madam Adeleke for the serious work wey she dey do to uplift Osun people through the renewed […]

todayDecember 9, 2025 12

National

Tinubu Wire Letter Give Senate Say Im Wan Send Army Go Benin Republic

By: Alice Iduh Wi oga Presido Bola Tinubu don write Senate say,  make dem allow am send Naija soldiers go Republic of Benin as di country ask for help after coup wahala wey bust on sunday. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for plenary, and Tinubu talk say na section 5(5) of di 1999 Constitution give am power to seek dis kind approval. Tinubu yarn say Benin beg […]

todayDecember 9, 2025 8

National

Ecowas Declare Emergency For West Africa Sake Of Security Wahala

By: Alice Iduh Di Economic Community of West African States, ECOWAS, Ecowas don provoke oh, declare state of emergency for all West Africa say region political and security wahala don tire dem. Na di Commission Presido, Omar Touray, dey yan dis one  on Tuesday for Abuja during di 55th Mediation and Security Council meeting. Touray tell im  ministers and diplomats say recent gbege show say dem need serious thinking about […]

todayDecember 9, 2025 29 1

Sports

Mbappe Wunjury Shake Real Madrid Ahead City Clash

By: Alice Iduh Real madrid french superstar kylian mbappe no show for training on tuesday as them dey prepare for big champions league clash against manchester city on wednesday. According to report, di 26-year-old striker weh don score 25 goals for 21 matches this season, break him finger for la liga match against celta vigo on sunday and e get other wahala wey dem sti dey treat for sick bed. […]

todayDecember 9, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app