News-auth

1164 Results / Page 70 of 130

Background

obodo oyinbo

Iran Arrest Four Politician Dem, Say Dem Dey Scarra U.S

By: Esther Ayoola Iran police on Sunday don arrest four persons, say na dem dey try “scatter di country” and work “for Israel and US side” particularly during January protest. According to report, Three of dem na big reform politician, say Azar Mansouri (head of Reform Front), Mohsen Aminzadeh (former diplomat), and Ebrahim Asgharzadeh (former lawmaker). Di fourth person dem nor tuk di name, but court say dem di pipo […]

todayFebruary 9, 2026 14

National

Akpabio Explain Say Senate No Stop Electronic Election Result Transmission

By: Esther Ayoola Senate President Godswill Akpabio, say Senate no remove electronic transmission of election results for di amendment wey dem dey work on. E tuk say lawmakers just wan discuss if e suppose dey mandatory make results dey show for real-time. Akpabio defend di amendment, say, badbelle pipo just  dey rush judgement based on part of di legislative work.

todayFebruary 9, 2026 13

National

Senate Call Emergency Sitting Over Electoral Act Palava

By: Esther Ayoola Senate don call emergency plenary sitting for Tuesday as pipo dey vex for di way senate take  dey handle fi  Electoral Act (Amendment) Bill, especially reports on  clause to comot real-time electronic transmission of election results. Di announcement come from Clerk of di Senate, Emmanuel Odo,  say, Senate Presido, Godswill Akpabio don order all senators make dem reconvene by 12 noon on Tuesday, February 10, 2026. Dis […]

todayFebruary 9, 2026 23

National

Kwara Attack: Abdulrazaq, Kogi, Ekiti Governor Visit Victims For Hospitals

By: Esther Ayoola Three govos, AbdulRahman AbdulRazaq of Kwara, Usman Ododo of Kogi and Biodun Oyebanji of Ekiti ni go visit di pipo wey terrorist attack wunjor for Woro community inside Kaiama LGA, as dem dey receive treatment for General Hospital, Ilorin. U sabi say, di attack wey hapun last Tuesday for Woro and nearby Nuku communities, kpai kpai about 100 pipo and drive many residents comot dia houses. Uptop […]

todayFebruary 9, 2026 15

National

FG Vow To Carry Peace Give Kwara Pipo Afta Terror Attack

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don clear matas dat wi oga Presido, Bola Ahmed Tinubu oh, and dat im very dey serious to bring peace back to Nuku and Woro villages for Kaiama Local Gornment Area of Kwara State, afta jaguda boys wicked doings for di area. Vice Presido dey tuk dis one on Saturday when e lead Federal Gornment delegation go sympathize with di people of Kaiama […]

todayFebruary 9, 2026 10

National

President Tinubu Make History To Do State Visit For UK After 37 Years

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu and Iyawo, Oluremi  go buy waka do two-day state visit to United Kingdom from March 18 to 19, 2026. Say na King Charles III invite dem officially and according to British royal family tuk tuk dem, say King Charles and Queen Camilla go host Tinubu and im wife, Oluremi Tinubu, for Windsor Castle. Dem announce di visit for dia official X page […]

todayFebruary 9, 2026 15

Lagos

Lagos Gorment Lock Ladipo Spare Parts Market

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment don seal Ladipo Spare Parts Market for Mushin on Sunday. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, ni dey yanyanpu dis mata give tori pipo, say dem take action based on say, traders dey throway thick dirty wey dey smell for road anyhow. E also complain say, illegal street trading dey hapun for inside and around di market. Wahab tuk say, gornment […]

todayFebruary 9, 2026 25 1

Lagos

Army To Touch Light Officers For Drug Dealings For Apapa

By: Esther Ayoola 81 Division of di Nigerian Army don begin touch light doings for Apapa, after chairmo of Apapa-Iganmu LCDA, Jimoh Saliu, accuse some military officers, dat, na dem dey give drug dealers leg for di area to misbehave. Untop aproko to tori pipo, Saliu say, based on di anyhow doings, one area wey dem dey call Gidan Drama, for Marine Beach, near Tego Army Barracks, don turn hide […]

todayFebruary 9, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds