News-auth

318 Results / Page 7 of 36

Background

Sports

Anthony Joshua Pay Tribute Giv Im Padi Dem Wey Kpai For Motor Crash

By: Esther Ayoola Anthony Joshua don pay heartfelt tribute to im two padi, Latif Ayodele and Sina Ghami, wey kpai for car crash on December 29 for Naija. AJ get small wunjury inside di accident, hospital discharge am, return back England, then later come back attend dia burial for last Sunday. E call dem “brothers” and “great men”, tuk say na only afta di crash,  e sabi how special dem […]

todayJanuary 9, 2026 3

obodo oyinbo

No Send Soldiers Go Ukraine, War Fit Sup – Russia Warn US, Europe

By: Esther Ayoola Russia don drop hard warning give US and Europe say make dem no try send soldiers go Ukraine, say if dat one happen, na bigger war go burst, as di fight don already drag near four years. Russia say foreign troops no go calm anything, e go only scatter di marras and cause face-to-face wahala. But US and European leaders still dey yarn about security cover for […]

todayJanuary 9, 2026 5

Entertainment

Ned Nwoko Yarn Say Regina Daniels Negative Drug Test No Mean Anything

By: Esther Ayoola Senator Ned Nwoko on Thursday, yarn say Regina Daniels negative drug test no mean anything, say na temporary abstinence. E post for im X page say recovery no be social media show, and no fit come from just one test result. According to am, short break no solve di real gbege as recovery need time, honesty and professional support. Di statement come from im media team, and […]

todayJanuary 9, 2026 5

National

Edo State To Vaccinate 2.2 Million Pikin For Measles-Rubella Inside Just 10 Days

By: Esther Ayoola Edo State dey plan to vaccinate 2.2 million pikin between 9 months and 14 years against Measles-Rubella as part of Nigeria Integrated Mass Vaccination Campaign. Dr Eseigbe Efeomon, Director of Disease Control and Immunization for ESPHCDA, yarn dis one for Benin City during parley wey dem organize for journalists. Di campaign don start for Northern states Oct 4–27, 2025, and Southern states go run Jan 20 – […]

todayJanuary 9, 2026 3

Lagos

Lagos House Of Assembly Don Pass ₦4.4 Trillion Budget For 2026

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don pass di ₦4.4 trillion 2026 Budget of Shared Prosperity enter law. Committee chairmo, Hon. Sa’ad Olumoh, present di breakdown for plenary on Thursday. Di budget get ₦171 billion increase and focus on roads and infrastructure, education, healthcare, economic growth and social development. According to di report, dis na third budget of di present administration and di final new-cycle budget for Governor […]

todayJanuary 9, 2026 6

National

Jaguda Bandits Say Enter Area For National Park Office For Oyo, Kill Five

By: Esther Ayoola Gunmen wey people dey suspect say na bandits attack National Park Service office for Oloka, inside Oriire Local Government Area of Oyo State, around 9 p.m. on Tuesday. Konfam gather dat, di jaguda boys enter late for night and attack di office, though reason for di attack never clear. Oyo State Police tuk tuk, Olayinka Ayanlade, confirm di attack, but say police still dey

todayJanuary 7, 2026 10

National

FG Clear Scholarship Marras For Morocco student

By: Esther Ayoola Federal Gornment don scarra tuk say dem abandon Nigerian students wey Morocco on scholarship, say dem nor abandon anybody, di information na false and misleading. Dis one come from statement wey Director of yanings for Federal Ministry of Education, Boriowo Folasade, release. According to Minister of Education, Dr Tunji Alausa, all Nigerian students wey dey on valid Federal Gornment scholarship under di Bilateral Education Scholarship Programme before […]

todayJanuary 7, 2026 4

National

FG: NARD Dispute Na Structural Issue

By: Esther Ayoola Federal Government don explain say di ongoing wahala between dem and di National Association of Resident Doctors (NARD) no be because dem no care, but na structural and policy issues dey cause am. Honourable Minister of State for Health and Social Welfare, Dr Iziaq Adekunle Salako, tuk dis on Wednesday for statement wey Statehouse release. Im explain say Tinubu gornment still dey committed to good relation with […]

todayJanuary 7, 2026 5

Sports

Gary O’Neil Be New Strasbourg Coach

By: Esther Ayoola French club Strasbourg don announce on Wednesday say Gary O’Neil go replace Liam Rosenior as dia new coach. Rosenior leave di Ligue 1 team on Tuesday to join Premier League side Chelsea. O’Neil, wey 42 years old, don play for clubs like Portsmouth and Middlesbrough and even represent England under-21s. For official statement, O’Neil tuk say e dey excited and proud to join Strasbourg, and e dey […]

todayJanuary 7, 2026 4 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app