News-auth

1021 Results / Page 6 of 114

Background

National

Presido Tinubu Salute Senior Man Aliko Dangote As Im Clock Plus One

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu don send congratulation to Nigerian billionaire Aliko Dangote as im add plus one to im age, hailing di seniorman role for Naija and Africa economic growth. For statement wey Special Adviser Bayo Onanuga release on Friday, Tinubu tuk say Dangote entrepreneurial vision, resilience and innovation don change key industries for di country. Tinubu highlight how Dangote big projects like refinery, petrochemical plants […]

todayApril 10, 2026 8

Sports

LeBron, Bronny Make NBA History With Father-Son Assist

By: Esther Ayoola LeBron James and im son Bronny James don make NBA history for Los Angeles Lakers 119–103 win over Golden State Warriors, as dem combine for rare father-son assist. According to Sport report on Friday, Bronny wey be 19 years old steal di ball for defensive play before con sharpaly pass am give im papa LeBron for fast break dunk. LeBron finish di move with easy dunk as […]

todayApril 10, 2026 4

Lagos

How Tanker Block Lagos-Ibadan Expressway Jam On Friday Morning

By: Esther Ayoola Say nor be small hold up for Lagos-Ibadan Expressway on Friday morning, as motors no fit move from Longbridge to Magboro and na so no dey come. According to report, na around 7:30am dis problem start afta one fuel tanker block road near Magboro bridge. Na so pipo dey complain, say e be like say everywhere just stand sti, especially for those wey dey go out of […]

todayApril 10, 2026 5

Lagos

Immigration Boss Suspend Lagos-Seme Border Commanders Say Dem Do Yahoo

By: Esther Ayoola Di Comptroller-General of Nigeria Immigration Service, Kemi Nandap, don shake table remove di commanding officers for Lagos-Seme border corridor, afta online report say di officers do extortion. She tuk say di action na to allow proper investigation and to make sure say all officers wey involve go face disciplinary action. According to NIS tuk, tuk on Friday, Akinsola Akinlabi, di service condemn di alleged bad conduct, say […]

todayApril 10, 2026 4

Sports

Barca Face Espanyol Derby Wahala Ahead Atletico Return Leg

By: Esther Ayoola Barcelona coach Hansi Flick like dis dey face serious decision ahead of dia La Liga derby against Espanyol for Saturday, afta dem lose 2-0 to Atletico Madrid for Champions League quarter-final first leg. Flick tuk say, dem go analyse all options because di match na very important match. Barcelona sti dey top La Liga with seven points ahead Real Madrid, but di gap fit reduce if Madrid […]

todayApril 10, 2026 3

obodo oyinbo

Germany Open Scholarship for African Graduates

By: Esther Ayoola Germany don open application for one scholarship programme wey dey target graduates and postgraduates from Sub-Saharan Africa, to give dem chance for further study and research abroad. Dem announce am for dia X handle on Friday, tuk say na part of their plan to support international academic cooperation. Dem say DAAD scholarship don ready now and make interested people check di flier for full details and apply […]

todayApril 10, 2026 2

Sports

AFCON Final Ref Miss Out As FIFA Pick World Cup Referees

By: Esther Ayoola FIFA don release list of referees wey go handle di 2026 FIFA World Cup 2026, wey go hapun for USA, Canada and Mexico with 48 teams. From Africa side, countries like Algeria, Egypt, South Africa, Morocco, Gabon, Angola, Somalia and others get officials wey FIFA pick. But big name referee like Congolese Jean-Jacques Ndala Jean-Jacques Ndala, plus Issa Sy and Boubou Traoré no make di final list.

todayApril 10, 2026 6

Sports

Super Falcons Cry Out As NFF Fail To Arrange Friendly Matches Ahead WAFCON

By: Esther Ayoola Super Falcons captain Rasheedat Ajibade and goalkeeper Chiamaka Nnadozie don voice dia frustration say di team nor get any friendly matches to play for dis international play. Dis FIFA women international window start on April 7 go reach April 18, wey suppose allow teams play at least three friendly games. But Naija Football Federation never sti announce any match for di Naija women's national football team, and […]

todayApril 10, 2026 6

Sports

Fury Tell Joshua To Forget Wilder Fight

By: Esther Ayoola Tyson Fury don tell Anthony Joshua say make im forget Deontay Wilder and focus on fight wey dem fit do next if he win Arslanbek Makhmudov on Saturday. Fury go come back from im 16 months break to fight Makhmudov for Tottenham Hotspur Stadium. Di British boxer dey push Joshua make e no go pick any interim fight, but instead make e face am direct. Meanwhile, Deontay […]

todayApril 10, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app