News-auth

1021 Results / Page 8 of 114

Background

Lagos

Fulani/Arewa Leaders For Lagos Quash Suspension Rumor Of Dia Chairmo

By: Esther Ayoola Arewa and Fulani leaders don gather stakeholders address dia leadership issues say dem nor suspend Alhji Sa’adu Yusuf Dandare-Gulma as chairmo. Fulani leader for Lagos, Alhaji Mohammad Abubakar, naim dey yan dis mata for dia stakeholders meeting wey dem run on Thursday, say, di suspension story na false and he officially cancel am, insist say Dandare-Gulma sti be chairmo. Other leaders like Mai Kano Lawal and Alhaji […]

todayApril 10, 2026 2

Lagos

President Tinubu Commission Big Tolu Schools Complex For Ajegunle, Lagos

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don inaugurate di remodelled Tolu Schools Complex for Ajegunle, Lagos State. Say, di complex wey dey Ajegunle get 31 secondary schools, 5 primary schools, plus vocational centres, science labs, ICT and robotics hubs. Represented by Senate Presido Godswill Akpabio, oga presido tuk how dis school take be good achievement, say na one of di biggest school collection for Sub-Saharan Africa.

todayApril 10, 2026 2

Lagos

Lagos New CP Tijani Show Report Card Say Command Gbab 47 Suspects

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Commissioner of Police, CP Tijani Olayiwola Fatai, don show report card say di Command don arrest 47 suspects and recover guns, vehicles and other exhibits, Di police, yan dis one during a press briefing wey dem arrange for police headquarters for Ikeja for Lagos. Im say, dis update na from when he assume office, and na through intelligence- policing and support from residents dem take […]

todayApril 7, 2026 6

Sports

How Maguire Sign New Contract With Man Utd

By: Esther Ayoola Manchester United don renew contract of dia former captain Harry Maguire, so like dis im go dey Old Trafford for at least another season. Di 33-year-old England centre-back, wey join United from Leicester for £80 million back in 2019, sign new one-year deal with option to extend further. Maguire take to im social media, express im happiness, say di tin sweet am, dat Representing Manchester United na […]

todayApril 7, 2026 5

obodo oyinbo

UN To Vote On How To Open Hormuz Strait, Trump Give Iran Deadline

By: Esther Ayoola Say like dis UN Security Council go vote to address do mata of di middle east, on how dem go unblock di Strait of Hormuz. Say nobody go use force, even for defense, but di aim na to find solution. Dis vote go hapun few hours before Donald Trump 8:00 pm deadline for Iran to make deal or U.S go destroy im power plants and bridges. Bahrain, […]

todayApril 7, 2026 3

National

Why Jos Youths Protest For Plateau Attack Victims

By: Esther Ayoola Say nor be small gbage, as Some youths for Jos North, Plateau State, block di burial ceremony of di Jos attack eviction wey bin dey sup for ECWA church. Wetin con cause di jogolo, dem say, security men arrest three boys wey allegedly bin dey defend di area from di jaguda boys wey come scatta area. Afta plenty protest, army release di three youths, and dem begin […]

todayApril 7, 2026 5

National

Abuja Court Slam 20-Year Jail On Boko Haram Suspect

By: Esther Ayoola Justice Binta Nyako for Federal High Court, Abuja, don sentence some group for jaguda boys wey dem catch terrorism on Monday to jail, some dey get 10 years, some 20 years jail. Sharing di ogbonge update with tori pipo, DPP Rotimi Oyedepo tuk say one of dem, Hamatu Modu, na Boko Haram, wey dey supply di terrorist food. Defence lawyer Aliu Abubakar no fight di case, and […]

todayApril 7, 2026 4

National

Resident Doctors Suspend Strike As Gornment Promise To Pay Arrears

By: Esther Ayoola National Association of Resident Doctors (NARD) on Tuesday announce say dem don suspend dia planned strike afta dem meet with Federal Government of Naija for Abuja. NARD say, gornment don promise to pay outstanding salaries, hazard allowance, and improve doctors welfare, wey be di main reason why dem decide give dialogue another chance. Di suspension come afta emergency meeting of NARD National Executive Council, where dem review […]

todayApril 7, 2026 4

National

Shettima Drop Assurance Again Say Naija No Go Fail

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don promise again oh say make Nigerians nor too worry body about security, say very soon all di gbege go be tins of di past. Oga Vice presido yarn dis one for di final day of di National Police Day parade for Abuja, saying dat reform plus unity go hellep push things forward. Shettima make am clear say everybody gat support police and […]

todayApril 7, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app