News-auth

1021 Results / Page 5 of 114

Background

Lagos

South West Commissioners Gather For Lagos, Plan New Way To Solve Housing Palava

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment Commissioner for Physical Planning and Urban Development, Dr. Oluyinka Olumide, don host im first meeting of South West commissioners for physical planning for Alausa, Ikeja. Commissioners from Lagos, Ogun, Oyo, Osun, Ekiti and Ondo all join hand with DAWN Commission and South West Development Commission tuk how dem go take build strong regional integration and beta urban development. Dem press tuk say di South […]

todayApril 13, 2026 2

Lagos

Lagos Lawmaker Tell Nigerians to Stop Blaming FG For Everything

By: Esther Ayoola One Lagos lawmaker, Temitope Adewale, don open secrete tuk say Nigerians, especially councillors, suppose hold local gornment chairmen accountable for how dem dey run things and deliver service. Im tuk am during interview with Newsmen on Sunday inside Lagos. Adewale explain say Supreme Court judgment wey hapun for 2024 don give all Naija 774 local gornments financial autonomy, so dem go dey receive money direct from federal […]

todayApril 13, 2026 2

Lagos

Police Open Investigation For Surulere Shooting

By: Esther Ayoola Di Lagos State Police Command on Sunday for dia official X handle @LagosPoliceNG don clear mata say dem don start investigation into di shooting wey kpai one-man wey dem dey call “Agali” for Surulere. According to report dis incident hapun on Saturday night around for National Stadium Bridge, Surulere. Video wey go viral on X show di damaged white car and crowd, and dem claim say e […]

todayApril 13, 2026 2

Lagos

CP Fatai Visit LASU Crash Scene, Promise Justice

Lagos state Commissioner of Police, CP Tijani Fatai and other senior police officers go di askident scene wey kpai student, do on-di-spot check and meet with LASU Students’ Union representatives. Di CP praise di students for how dem dey calm, orderly and responsible even afta dem lose dia colleague. He assure say justice go dey served, and say di suspect go enter court on Monday for proper prosecution. Di Command […]

todayApril 13, 2026 2

Lagos

How LASU Student Kpai for Hit-and-Run Askident For Igando

By: Esther Ayoola Lagos State University management on Sunday don konfamate and explain how a 300-level student, Azeezat Abdul-Rasheed, kpai afta fatal askident wey hapun for Igando on Saturday night. According to report, di askident hapun around 7pm when one suspected hit-and-run driver jam di student, and she later kpai for hospital because of di wunjuries. Leaders of National Association of Nigerian Students Joint Campus Council Lagos, led by Ridwan […]

todayApril 13, 2026 1

Lagos

Lagos Police Command Kramp 3 Suspected Robbers, Recover Bike, Phones and Weapons

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command say dom don do small Rambo arrest three suspected armed robbers for Car Wash Bus-Stop, for Idimu area. According to Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, di operatives on routine patrol naim stop and search di suspects when dem see dem on motorcycle and dem recover machete, army camouflage cloth, four phones, power bank, small cash and Bajaj motorcycle wey dem dey use […]

todayApril 10, 2026 10

Lagos

President Tinubu And Folarin Hold Late Night Meeting For Ikoyi

By: Esther Ayoola Wi Oga Presido, Bola Tinubu don go run small praol with APC chieftain for Oyo State, Teslim Folarin, for him private residence for Ikoyi, Lagos. Folarin naim later dey konfamate dis mata for Facebook page, though im nor really tuk wetin dem discuss for di meeting. People dey reason say di reason for the meeting na because APC dey plan ahead for 2027 Oyo State governorship election […]

todayApril 10, 2026 9

Sports

Harry Maguire Claim Say Im Na Sti One Of Di World Best Defenders

By: Esther Ayoola Harry Maguire don go drop micro soft words say im sti be one of di best defenders for world football even as age don dey go. Di Manchester United and England national team player yarn dis one for interview with Sport expert, where e confidently rate himself among top defenders. As Fabrizio Romano report for X, Maguire tuk say e sti dey perform well for both defence […]

todayApril 10, 2026 6

Sports

PFL Africa To Land Lagos For Big MMA Fight June 13

Senior boxers wey dey under di umbrella of Professional Fighters League don announce say dem wan host one big MMA show for Lagos. Say in fact, PFL Africa go land Naija for di first time on June 13, 2026 for Eko Convention Center. Dem say di event go be di biggest MMA show wey ever for West Africa, with bantamweight and lightweight tournament fights plus other strong fighters from di […]

todayApril 10, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app