News-auth

1164 Results / Page 9 of 130

Background

obodo oyinbo

US Presido, Trump Give Big Announcement Say Ceasefire With Iran Likely To Continue

By: Esther Ayoola U.S presido, Donald Trump don make public announcement, say di ceasefire wey dey between US and Iran go sti continue till two countries go complete dia peace tuks. Di senior man sti put for im Truth social say, di blockade wey dem put for Iran ports go sti dey, until Tehran bring one clear and united proposal. Say like dis, nobody too sure how di US-Iran tuks […]

todayApril 22, 2026 11

National

Peter Obi Torch Light Federal Gorment 135bn Election Court Spending

By: Esther Ayoola Di 2023 presidential candidate of Labour party, Peter Obi once again don drag wi Federal Gornment oh, say dem spend billions for election court cases instead of to investing. Im yarn dis one for public lecture wey hapun for Coal City University, Enugu State, say di ₦135.22 billion wey dem plan for post-election mata, nor suppose dey. According to am, dat kind money fit help support graduates […]

todayApril 22, 2026 8

National

President Tinubu Do Small Cabinet Change, Edun To Pass Baton Oyedele

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don approve small cabinet reshuffle wey affect two ministers for Federal Executive Council. Minister of Finance, Wale Edun, go hand over to Taiwo Oyedele wey go become new Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy. Also, Minister of Housing and Urban Development, Ahmed Musa Dangiwa, go hand over to Muttaqha Rabe Darma wey don dey nominated as minister designate. […]

todayApril 22, 2026 16

National

VP Shettima Tuk Why Mehn Need Explain President Tinubu Policies

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don go tell Naija tuk, tuk pipo say make dem dey rep dis kontri wella, break down gornment policies, so dat mama Nkechi and baba Bayo go understand for market. Di vice presido yarn dis one for Kaduna during NIPR Week 2026, where dem gather Tuk, tuk pipo from different places, celebrate dem. According to Shettima, Baba Seyi reforms nor go make complete […]

todayApril 22, 2026 11

National

President Tinubu Declare Say No Shakement For Naija Democracy

By: Esther Ayoola Wi oga Presido, Bola Tinubu don make am clear say, e nor get how as e go be, say democracy for Naija go stand  fit,  no mata di intimidation. Im yarn dis one when im receive big delegation from Enugu State, wey Peter Mbah carry come State House. Tinubu praise Mbah for di work wey im dey do to fight insecurity and improve health, education, and infrastructure […]

todayApril 22, 2026 13

National

Why Adeleke Make Afro Star Davido Head of Im Re-Election Campaign for Youths

By: Esther Ayoola Afro beat star, Davido don take new role as head of youth mobilisation for Accord Party campaign council for Osun State. Say na im uncle, Governor Ademola Adeleke, na im appoint am as dem prepare for di August 2026 governorship election. Davido share di news for im X page, unto how dem wan take run a smooth campaign and secure victory. According to reports, say na based […]

todayApril 22, 2026 12

Lagos

Truck Kpai Anoda Dispatch Rider For Otedola Bridge, Lagos

By: Esther Ayoola Say Anoda dispatch rider don lose im life again for road askident for Lagos State, less than 24 hours afta similar one hapun for Alapere area. According to di tuk, tuk of Lagos State Traffic Management Authority, Adebayo Taofiq, statement on Tuesday, di crash hapun for Otedola Bridge inward Secretariat for Ogudu Toll Gate Road, as heavy-duty Volvo truck jam di rider. Lagos State Traffic Management Authority […]

todayApril 22, 2026 11

Lagos

Police Waka Lagos To Rascal One Chance Kidnappers

By: Esther Ayoola Di Lagos State Police command don carry work for head dey do on di spot check to rascal all di rascalities for inside di obodo Lagos. Say dis waka na, Oga commissioner, Fatai Tijani naim lead di waka by imself on Tuesday for di city. According to di Commissioner, di Tuesday waka sef na based on complains from Lagosians about one chance motors, and how dem take […]

todayApril 22, 2026 17

Lagos

Lagos First Lady Group Dash 11 Orphanages N60m Support

By: Esther Ayoola Say nor bi small betament hapun for Lagos oh, dat not fewer than 11 orphanage homes for Lagos receive household items and welfare support worth about N60 million from Committee of Wives of Lagos State Officials. Dis donation, wey First Lady Dr. Ibijoke Sanwo-Olu lead, hapun for Banquet Hall of First Lady Office for Alausa, Ikeja. Gornment tuk say di support include cash cheque for school mata […]

todayApril 22, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds