News-edi 1

2593 Results / Page 106 of 289

Background

OBODO NAIJA

NDLEA Bust Big Drug Syndicate, see  Cocaine wey dem Hide

Wi National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA don buy robo cup waka scatter one big drug syndicate for Lagos, say dem don dey track am for three weeks. Director of Media and Advocacy, Femi Babafemi,  na im dey yarn dis one on Sunday for Abuja. say dem discover cocaine wey dem hide for tins wey get palm kernel extract. Dat di plan before na to send di drugs go United […]

todayApril 6, 2026 20

Lagos

LASEMA Report Two Fire Incidents For Lagos After Electrical Surge

Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don share ogbonge update say na two separate fire gbege na im hapun for Lagos on Sunday, an all na electric na cause am. LASEMA tuk tuk oga, Afolabi Olawale,  na im dey konfamate dis mata as tori pipo bin dey touch light im frequency for dia office Lagos. Say di first fire hapun for FESTAC Town Phase 2 when one conduit wire spark […]

todayApril 6, 2026 27

Lagos

Governor Sanwo-Olu Enter 50-Year Property Agreement With Ikoyi-Property Owners

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu don approve 50-year rent package for pipo wey get property for Ikoyi-Obalende area. Di announcement come out through im special adviser on e-GIS and Urban Development, Olajide Babatunde, during one stakeholders meeting wey hapun for Ikoyi. Babatunde clear matas say dis approval na result of plenty years of discussion between Lagos State gornment and Obalende residents about di future of di community.

todayApril 6, 2026 35

OBODO NAIJA

How Oga Presido Tinubu Dey Get Sleepless Night Because of Insecurity

Wi Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris,  say like dis, wi oga  Presido Bola Tinubu dey work harder now to join hand with other countries make dem fit stop insecurity for Nigeria. Idris yarn dis one to journalists after im meet di President for Lagos on Sunday. Im talk say Tinubu dey reach out to neighbouring countries and international partners to fight problems like terrorism wey don scatta […]

todayApril 6, 2026 31

Sports

Chelsea Suspend Enzo Fernandez Say Im Break Club Rules

Say like dis na, Enzo Fernandez no go play for Chelsea for di next two matches after im talk about im future. Dis na according to update by coachie Liam Rosenior for im pre match conference. According to Rosenoir, di club get ruled and Enzo don pass di line as make comment say im wan join Real Madrid. Di 25-year-old Argentine wey join Chelsea January 2023 for record £107 million, […]

todayApril 3, 2026 37

obodo oyinbo

Iran Raise Alarm For Strait of Hormuz Security Vote Postponement

Iran don warn di UN Security Council say make dem nor do any “provocative action”, ahead of a scheduled vote wey dem wan take settle di wahala for strait of Hormuz. Iranian Foreign Minister Abbas Araghchi na drop dis yarnings ahead of di Security Council suppose vote on draft resolution. Say di resolution na to hellep create force to secure di shipping lane wey dey vital to global energy supply. […]

todayApril 3, 2026 34

Lagos

Lagos CP Tijani Fatai Tight Security Wella Ahead Of Easter

For Lagos state police command, commissioner of police, Tijani Fatai don order massive deployment of officers across di state to make sure say pipo dey safe before, during, and after easter celebration. According to a statement released by police tuk tuk , Abimbola Adebisi, on Friday, say di police go station officers for churches, highways, parks, transport hubs and other important places to stop any wahala. Dat dem go also […]

todayApril 3, 2026 32

OBODO NAIJA

Wike Confirm Say PDP Go Enter 2027 Election

Federal capital territory minister, Nyesom Wike don share update say Pipos Democratic Party go surely contest for 2027 general election, despite wetin pipo dey tuk say di party no get wait again. Im yarn dis one on Friday during one media meeting, wia im clear every, say PDP still dey strong even though say dem never produce president since 2015. According to Wike, di party need focus more on state […]

todayApril 3, 2026 37

Politics

Umahi Urge South East Big Men To Support Bola Tinubu

Oga Minister of Work, David Umahi don tell im South East leaders say make dem come out with dia full chest support Bola Tinubu based on wetin di senior man don do for south east pipo. Im tuk dis one on Thursday for Enugu during di opening of completed part of di Enugu, Onitsha federal highway. Umahi come tell Hope Uzodimma to organise leaders for di zone make dem loudly […]

todayApril 3, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds