News-edi 1

2593 Results / Page 134 of 289

Background

Lagos

Lagos Go Close Apongbon Bridge For Six Weeks For Repairs

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Govment, don join body with Federal Ministry of Works, don announce say dem go start repairs for failed asphalt parts of ramp and service lane wey connect Inner Marina to Apongbon Bridge, plus some parts of di bridge lanes. State Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, tuk say di work go start for service lane on Thursday, February 5, and e dey expect say e go […]

todayFebruary 5, 2026 36

Sports

Wilfred Ndidi Pay Emotional Tribute Giv Im Late Papa

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, Wilfred Ndidi, don pay emotional tribute to im papa, Mr Sunday Ndidi wey tragically die yesterday afta one car run am for Umunede, near Agbor for Delta State. Ndidi Turkish Super Lig club, Besiktas, don announce say senior Ndidi don die for dia X handle yesterday, and dem still send condolence to di retired soldier. Di Super Eagles Captain for emotional post for im […]

todayJanuary 29, 2026 37

OBODO NAIJA

Turkish Official Defend Tinubu Fall Wahala – Abike Dabiri

By: Rilwan Agbomeji Di palava wey burst for Naija over President Bola Tinubu small stumble during im official visit to Türkiye, Turkish officials don wave am comot hand, call am silly, according to Chairman of Nigerians in Diaspora Commission, Abike Dabiri-Erewa. Dabiri-Erewa yarn dis one on Wednesday as she dey answer one post for X from Oguntoye Opeyemi wey talk about how Naija media carry di marras. She talk say, […]

todayJanuary 29, 2026 27

OBODO NAIJA

We No Giv Order Say Make Tear Gas Scatter Protesters – Lagos Lawmakers

By: Rilwan Agbomeji Lagos State House of Assembly don clear members of di House say dem no get any hand for alleged order wey talk make dem fire teargas and arrest protesters for di Assembly gate on Wednesday. No forget say plenti protesters jam di Assembly gate on Wednesday to show say dem nor happy with di demolition wey State Govment do for Makoko area. Di clarification dey inside statement […]

todayJanuary 29, 2026 21

obodo oyinbo

Iran Ready To Strike US If Gbege Happen

By: Rilwan Agbomeji Iran foreign minister, Seyed Abbas Araghchi don yarn say Iranian army dey ready to immediately and powerfully strike back if US try attack dem. Di warning land just hours afta US Presido Donald Trump yarn again say dem fit carry military action come. Di USS Abraham Lincoln, one nuclear-powered aircraft carrier, na one of di many military tins wey US don send go Arabian Sea these past […]

todayJanuary 29, 2026 33

OBODO NAIJA

Jaguda Boys Gbab Youth Leader For Tinubu-Shettima Campaign

By: Rilwan Agbomeji  Jaduga boys wey people dey talk say na bandits don kidnap Ambassador Bashir Isa Gusau, North-West Youth Leader for Tinubu/Shettima campaign for Zamfara State. Di mata first show for public afta security analyst Bakatsine post am for X on Thursday. According to di post, pass 30 Jaguda boys waka enter Gusau house for Gusau town, gbab am as di gbebe dey happen. Gusau family dey distressed like […]

todayJanuary 29, 2026 42

OBODO NAIJA

Minister Wike Warn Striking Workers Make Dem Go Back To Work

By: Rilwan Agbomeji Oga Minister of Federal Capital Territory, Nyesom Wike, don sama beta warning to di striking Federal Capital Territory workers, say make dem behave oh or face legal problem wey get odour. Wike yarn dis on Tuesday as e talk to journalists, afta National Industrial Court order say make di strike stop. According to Wike di court ruling must stand, and dat any person wey dem catch go […]

todayJanuary 28, 2026 45

obodo oyinbo

Starmer Land China, Seek Beta Trade And Fresh UK–China Relationship

By: Rilwan Agbomeji UK Prime Minister Keir Starmer don waka go China for three days visit, becoming di first UK PM to go dere since 2018. E travel with about 60 British business and culture leaders, and e go meet Chinese President Xi Jinping to talk about trade and beta relationship. Inside di plane, Starmer tell reporters say e wan correct and steady China policy. Dis visit show say di […]

todayJanuary 28, 2026 33

OBODO NAIJA

Employ 200 Judges Enter Court – Presido Tinubu Yarn

By: Rilwan Agbomeji Wi oga Presido, Bola Tinubu say, don go send message give wi Senate to  propose 200 more judges for Court of Appeal and Federal High Court. Tinubu say di plan na to make di judiciary strong wella and reduce di plenty cases for court. Dis request dey inside two different bills wey dem read for Senate plenary on Tuesday by Senate President, Godswill Akpabio, as lawmakers resume […]

todayJanuary 28, 2026 44 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds