News-edi 1

1469 Results / Page 143 of 164

Background

Sports

DR Congo Fans Scatter Stadium After Dem Chop Beating from Senegal

Football fans for DR Congo lose control Tuesday evening as dem run mad and scatter parts of Stade des Martyrs for Kinshasa after their team chop 3-2 loss from Senegal for 2026 World Cup qualifier. Di 80,000-capacity stadium full to the brim as di Leopards dey chase one historic win wey for push dem closer to qualify for next year World Cup, but as hope scatter, everywhere burst. Hope bin […]

todaySeptember 11, 2025 58

Lagos

“Lagos NOA Don Start Two-Week Campaign”

National Orientation Agency (NOA), Lagos State don kick off one two-week campaign wey dey aim to wake citizens mind make dem sabi government policy, national identity, safety, values, and development. Di State Director of NOA, Dr. Mustafa Adedeji Tukur, wey yarn dis one for press conference wey dem do for di agency headquarters for Dopemu, talk say as part of di program, dem go waka go schools, motor parks, markets, […]

todaySeptember 11, 2025 39

Lagos

Police Don Grab Fake ‘Obi Of Lagos’, Jam Lock Him Palace!

Lagos Police don carry one 65-year-old man wey talk say na him be “Obi of Lagos” plus three of him padi dem on Wednesday. The suspect, Engr. Chibuike Azubike from Obodoukwu Ancient Kingdom for Imo State, na im dem hold together with Chief Chibuzor Ani, 57; Chief Martins Nwaodika, 65; and Mr. Ikechukwu Franklin Nnadi, 41. Police talk say dem gather correct intel wey show say di group don plan […]

todaySeptember 11, 2025 19

Lagos

Lagos People Don Vex Scatter Over Blackout, Storm Ikeja Electric Head-on!

Residents wey dey Governor’s Road, Ikotun for Alimosho Local Government, Lagos don face Ikeja Electric serious gbas gbos over power wahala wey don hold ground for over 10 days straight. Di chairman of Igando Peace Estate Phase IV CDA, Emmanuel Joseph, wey speak on top di matter for residents, para say di blackout don make life hard for both families and business people for di area, scatter daily activities, and […]

todaySeptember 11, 2025 30

Sports

2026 FIFA World Cup: Bolivia Don knack Playoff, Just Dey Wait Who Go Show From CAF And Other Confederations!

Bolivia don officially knack im ticket go intercontinental playoffs for 2026 FIFA World Cup after dem finish seventh for CONMEBOL qualifiers. Di South American country gather 20 points from 18 matches, grab di only playoff spot wey di region get. Bolivia go now jam opponent wey go come from Africa plus other four Confederations. But for Africa side, their own representative go come from one small playoff wey go hold […]

todaySeptember 11, 2025 29

Lagos

Lagos Don Slash Malaria Rate Reach 1.3%, Eye Total Wipe Comot

Na serious health win be this as Lagos don almost commot malaria finish. From 15% back in 2010, di malaria rate don drop like stone reach 1.3% as of March – April 2025. Na Jennifer Anyanti, Deputy Managing Director, Strategy from Society for Family Health (SFH) yarn dis one. She talk say di level wey Lagos reach now na almost record low, and e don nearly match wetin World Health […]

todaySeptember 10, 2025 24

Lagos

Sanwo-Olu Yarn Say Women And Youth Must Enter Politics

Lagos State Governor, Babajide Sanwo-Olu, don tell women and youths make dem no sidon look say make dem enter politics and government matter with boldness. E talk say na dem hold the key to Nigeria better tomorrow. Sanwo-Olu no show, na him wife, Dr. Ibijoke Sanwo-Olu, come carry him talk for APC Lagos State Women’s Summit wey happen yesterday. Dem theme na “Arise, Aspire, Ascend.” The governor talk say women […]

todaySeptember 10, 2025 21

Lagos

“Lagos Assembly Don Yarn Say Dem Go Enter Onikoyi Royal Family Chieftaincy Wahala Make E Settle Sharp Sharp”

Lagos State House of Assembly don talk say dem no go fold hand watch as serious chieftaincy gbege dey scatter the Onikoyi Royal Family, dem say dem go step in sharp-sharp. This one happen after members of the royal family storm Assembly gate yesterday with peaceful protest, beg lawmakers and the state government make dem stop the alleged “one-sided” installation of a new king. Hon. Rauf Age-Suleiman, wey dey represent […]

todaySeptember 10, 2025 43

Lagos

Lagos Don Gear Up To Fight Food Waste – Mega Storage Go End Post-Harvest Loss Wahala

Lagos State Government don set plans to fight post-harvest losses with one mega food storage facility wey dem go commission by December 2025. Di facility get capacity to hold enough food wey fit feed people for di state for 90 days straight. Di storage centre, wey dey Epe, na part of di state’s food security system and logistics hub wey go help manage supply and control food waste. Na Lagos […]

todaySeptember 10, 2025 40

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app