News-edi 1

2355 Results / Page 144 of 262

Background

National

Bandits Don Waka Adamawa Community For Sokoto, Burn Houses and Shops

Bandits don bring dia werey come anoda attack for Adamawa community for Kalgo Ward, Sabon Birni LGA, Sokoto State, dem even burn three houses and one shop, dey waka waka dey put fear for pipo mind up and down. Di gbege burst yesterday night, but We thank God say dem no carry and kill anybody as dem dey do dia yeye operation. Among di house wey dem burn na dat […]

todayDecember 2, 2025 16

National

Northern Govs Wan Lock Mining For 6 Months, Scatter Ground With ₦228bn Security Cash

Govos and Traditional Rulers for north don form geng enter meeting for Kaduna, order say make mining stop for at least six months, and dat illegal mining, na im dey cause all di katakata of security for di North. Di leaders dey para say dat pipo dey face serious gbege wit Jaguda boys and so don set up regional Security Trust Fund, wey every state and local gornment go drop […]

todayDecember 2, 2025 17

Sports

We Go Block Osimhen Goal – Skriniar

Fenerbahce captain, Milan Skriniar don fire warning shot, talk say dem ready lock Victor Osimhen completely as di Istanbul derby go burst tonight for RAMS Park. Galatasaray dey top table with one point, and dis match don turn full-blown city war as both sides dey ginger for supremacy. On top post for X, Skriniar yarn say Osimhen and Icardi fit be hot strikers, but tonight, Fenerbahce dey come rugged, compact […]

todayDecember 1, 2025 55

foreign

Cash Don Finish For Sudan, Pipo Dey Swap Goods, Run Credit

Sudan economy don kpafuka, money don vanish comot, everywhere don turn wahala zone, one euro wey before dey 450 pounds now dey sell 3,500 for black market, money don disappear everywhere. Banks don loot, cash don vanish, people don dey swap everything, chairs, hoes, cloth, even fridge, just to chop, buy fuel or run generator. Civil servant Ali for Dilling talk say e never see banknote for over nine months, […]

todayDecember 1, 2025 61

National

Jonathan Brief Tinubu On Guinea-Bissau Wahala

Former Presido Goodluck Jonathan don land for Aso Rock to give Presido Tinubu full gist of wetin shelle for Guinea-Bissau election, as tradition demand anytime former presido handle regional wahala. Jonathan talk say di election don already finish, results dey almost complete, and di only correct next step na to announce who truly win instead of dis confusion wey don drag military enter matter. E beg ECOWAS leaders make dem […]

todayDecember 1, 2025 27

National

Atiku Demand Make Dem Probe N17.5tn Pipeline Security Money

Former Vice Presido, Atiku Abubakar don drag President Bola Tinubu gornment for Abuja on Sunday, say how dem spend N17.5tn on pipeline security and related wahala for just one year. Na for inside statement wey dem wrap like moi moi through di Atiku news waka waka dem, on Sunday, in yanyanpu dis one say,  di money pass 12 years wey Nigeria dey pay fuel subsidy wey dey help millions of […]

todayDecember 1, 2025 16

National

Taraba Governor Go Meet Tinubu For Aso Rock

Taraba Governor Agbu Kefas don go Aso Rock to meet Tinubu for closed-door session, E waka enter inside di Presidential Villa around 2pm on Monday. Dis na im first visit since e dash PDP goodbye join APC, and e waka enter di State House with APC National Chairman, Prof. Nentawe Yilwatda. Kefas cancel im APC welcome wey suppose hold November 19, say e no make sense to celebrate while Kebbi […]

todayDecember 1, 2025 21

National

FG, Asuu Don Enter Talks On 40% Pay Rise

Na wah o! Federal Gornment don yarn say dem wan give ASUU lecturers 40% salary increase, according to di pipo wey follow tori pipo talk for Abuja. Dis one land as ASUU leaders dey ready to waka back go negotiation table with Federal Gornment team wey Yayale Ahmed lead, afta dem don finally settle matter and hammer deal for ASUU National Executive Council meeting for Abuja last Sunday. Branch leaders […]

todayDecember 1, 2025 19

National

FG Go Soon Name People Wey Dey Finance Terrorism

Di Special Adviser to President Tinubu on Policy Communication, Daniel Bwala, don drop bombshell say Federal Government go soon expose di big men and networks wey dey pump money into terrorism for inside Nigeria. Bwala yarn for TV sit don talk say Tinubu administration don dey take heavy, far-reaching security decisions, and Nigerians go soon see clearly who dey sponsor, shield and empower terrorists across di country. E add say […]

todayDecember 1, 2025 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds