News-edi 1

2593 Results / Page 145 of 289

Background

obodo oyinbo

Yemen Wahala, Say Saudi-Pipo An Separatists Scarra Yemen Border With Fight

By: Rilwan Agbomeji Fighting don break for Yemen, for Hadramout province wey dey near Saudi Arabia, between forces wey follow Saudi-backed govo and di Southern Transitional Council (STC) separatists. STC talk say Saudi Arabia dey bomb dia pipo near di border, but oga govo,  Salem al-Khanbashi yarn say dem just wan take back military bases “peacefully and systematically.” STC tuk, tuk, Lieutenant-Colonel Mohamed al-Naqib yarn say dia dey fight serious […]

todayJanuary 2, 2026 25

Sports

Super Eagles Star Lookman Make CAF Best XI

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles forward Ademola Lookman sef make di best players list for group stage of 2025 AFCON, and na di only Nigerian wey dey di team. CAF pick lookman as one of three midfielders alongside Morocco own Brahim Diaz and Cameroon own Carlos Baleba. Lookman score two goals and give two assists for only two matches, including di match-winning goal against Tanzania. Meanwhile, Nigeria coach Eric Chelle […]

todayJanuary 2, 2026 60

OBODO NAIJA

Nasarawa Govment Beg Lecturers Make Dem Stop Strike

By: Rilwan Agbomeji Di Nasarawa State Govment don beg lecturers wey dey strike for state tertiary schools, say, make dem stop dia action so negotiation fit continue. Joint Unions of Nasarawa State Tertiary Institutions (JUNSTI) don enter strike since December 29, 2025 because govment never pay full new minimum wage. Senior Special Assistant to Govo Abdullahi Sule tuk say di strike fit affect students as schools suppose don resume. E […]

todayJanuary 2, 2026 31 15

Sports

Lawal Wire SMS To Coach Eric Chelle To Tidy Eagles Defence

By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder Garba Lawal don advise Super Eagles Coachie, Eric Chelle and im technical crew say make dem sort di defensive issue of di super eafles for round of 16 Nigeria go face Mozambique Mambas on Monday for Fez Stadium to fight for quarter-final spot. Di former midfielder yarn am for on siddon talk show as fans dey ready cheer Nigeria for AFCON. Lawal talk say […]

todayJanuary 2, 2026 41

OBODO NAIJA

Malami And Im Pikin Go Still Siddon For Kuje Prison Reach January 7

By: Rilwan Agbomeji Former AGF and Justice Minister, Abubakar Malami, and im pikin, Abubakar Abdulaziz Malami, go remain for Kuje Prison reach January 7. Justice Emeka Nwite give di order on Friday afta court hear argument for and against dia bail application. Federal Government dey try Malami, im pikin and one Ramadiya Property staff, Hajia Bashir Asabe, over alleged ₦9 billion money laundering case. Court go decide on dia bail […]

todayJanuary 2, 2026 35

Obodo Niger

EFCC Drag Malami, Son, Wife Go Court On Top ₦8.7bn Gbege

By: Rilwan Agbomeji Former AGF Malami, im pikin Abdulaziz and one of im wives, Bashir Asabe, don face court over alleged money laundering case. EFCC charge dem with 16 counts, say dem wash ₦8.7 billion. All three people plead not guilty when dem carry dem go court on December 29, 2025. Justice Emeka Nwite order make dem remain for Kuje Correctional Centre till January 2, 2026, when court go hear […]

todayJanuary 2, 2026 54 2

Obodo Niger

Police Comot Hand For Tinted Glass Permit Marra

By: Rilwan Agbomeji Nigeria Police Force don suspend di nationwide enforcement of tinted glass permit afta court give interim order to stop am. Police bin plan to start di enforcement January 2, 2026, say na for public safety. According to Force PRO Benjamin Hundeyin, court serve police order on December 17, 2025, make dem no continue pending when court hear di main case. Police don enter appearance for court, raise […]

todayJanuary 2, 2026 35

Sports

Venus Williams Come Back Australian Open At Age 45

By: Rilwan Agbomeji Seven-time Grand Slam champion Venus Williams don get wildcard to play Australian Open at age 45, and tournament organizers talk say she go be di oldest woman wey ever play di competition. She still tuk say Australia give her many good memories and she thankful for di chance to come back to a place wey mean plenty to her tennis career. Officials confirm say Williams go break […]

todayJanuary 2, 2026 29 3

obodo oyinbo

Trump Say US Go Kwak Iran If Dem Kill Peaceful Protesters

By: Rilwan Agbomeji Unto mata for Iran, say US presido Donald Trump say America ready oh,  to robo cup for Iran gorment , if dem try kill protesters, say cost-of-living dey kill di living for Iran, as mehn dey protest am. Clash happen for different Iranian cities, and report tuk say six people don die since di protest increase. For Tehran, shop owners close dia  shops to protest high prices […]

todayJanuary 2, 2026 39

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds