News-edi 1

2355 Results / Page 141 of 262

Background

obodo oyinbo

Burkina Faso Free 8 NGO Members Wey Arrest For Spying

Burkina Faso military don finally free eight NGO members wey dem hold tight for months for alleged spying, include foreigners from France, Czech, Mali plus four Burkinabe nationals. Dem arrest di people for July, but junta no yarn anything till October, after dem dash ban to 21 NGOs, including Netherlands-based INSO. INSO yarn say dem dey happy well-well say dia colleagues don finally free and dem thank everybody wey help […]

todayDecember 5, 2025 32

obodo oyinbo

EU Sama Musk X Wit €120m, Fit Shake Trump Mood

EU don sama Elon Musk X wit €120m fine for breaking digital rules, and e fit scatter Trump side. Na first-ever fine under Digital Services Act, as X no clear transparency, dey play wit blue check for verified account. EU tech oga, Henna Virkkunen, yarn say na transparency mata, no be censorship, but US VP JD Vance don fire warning make dem no dey attack American company.

todayDecember 5, 2025 20

National

Tinubu Collect Diplomatic Letters From 21 Envoys

President Tinubu don collect diplomatic letters from 21 new envoys, 17 ambassadors and four high commissioners, inside Council Chamber. Tinubu talk say Naija ready to strengthen friendship, push cooperation and stand strong for peace and progress across borders. Japan ambassador, Suzuki Hideo, call di ceremony historic and hail Nigeria as ECOWAS heavyweight. Envoys come from Japan, Chad, Gabon, Türkiye, Palestine, Spain, Indonesia, Mauritania, Austria, Thailand, Bangladesh, Sweden, Czech Republic, Liberia, […]

todayDecember 5, 2025 30

National

Reps Drag Women Affairs Ministry On Gender Equality And Welfare

Di House of Reps committee on women affairs don yarn make Ministry of Women Affairs deliver proper, dey promote gender equality, protect women and girls rights, and push welfare mata well well. Di committee chairperson, Hon. Kafilat Ogbaran yarn dis dis week during oversight meeting with Hajiya Imaan Ibrahim for National Assembly. She yarn say dis oversight na to confirm say money wey dem dey drop go giv Naija women […]

todayDecember 5, 2025 18

Sports

Ndidi Go Captain Super Eagles After Troost-Ekong Retirement

Wilfred Ndidi don become Super Eagles captain for AFCON 2025 afta Troost-Ekong retire. Ndidi, wey don lead Eagles for 2026 FIFA World Cup African playoffs, na now im dey front line as di most senior padi for di team. Di 28-year-old Besiktas star don make 71 appearances since 2015, and then Moses Simon go dey back am up as assistant captain.

todayDecember 5, 2025 19

National

Imo Police Burst 2 Kidnappers, Nab 12

By: Rilwan Agbomeji Imo police don scatter 2 kidnappers, lock 12 for ceil, recover one dead body, dangerous weapons and 12 phones for Obudi/Mgbala Road and Umuezeruokam Forest. DSP Okoye yarn say DPO squad run down geng wey dey use white mini bus, while CP Danjuma promise say dem no go gree for kidnappers again. Meanwhile, police don para, reject all talk say dem dey do human rights wahala for […]

todayDecember 5, 2025 20

Sports

Amorim Vex Say Man Utd Just Dey Waste Chances

By: Rilwan Agbomeji Manchester United boss Ruben Amorim don para after im players waste plenty chances as dem throway 1-0 lead take draw 1-1 with struggling West Ham for Premier League on Thursday. Amorim, wey dey fight to drag United comot from 8th position, blame im boys say dem no get killer instinct as dem don repeat di same wahala against Tottenham, Nottingham Forest, and even lose 1-0 to 10-man […]

todayDecember 5, 2025 14

National

Tinubu 65 Ambassadorial Nominees Brace For Senate Grilling

By: Rilwan Agbomeji Next week, wi Presido Bola Ahmed Tinubu 65 ambassadorial nominees go siddon for front of lawmakers for grilling, to know whether dem dey qualify or not. Three opposition senators wey yarn under cover don drop warning say dis screening no be cruise, na only people wey get brain, backbone and clean name go escape, because foreign mission work no be job for smallie dem. For Thursday main […]

todayDecember 5, 2025 33

Sports

Troost-Ekong – Wetin Make Me Retire From Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles Captain, William Troost-Ekong don explain why e retire ahead of 2025 AFCON. Di 32-year-old defender wey don dey carry Naija flag for almost ten years don officially waka comot on Thursday, draw curtain on im international wahala. Even though Éric Chelle put im name for di provisional AFCON list, Ekong talk say e no go follow because na now im feel say time don reach […]

todayDecember 5, 2025 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds