News-edi 1

1747 Results / Page 148 of 195

Background

International

Hamas Don Start Dey Give Back Israeli Hostages

Hamas don begin to give back Israeli hostages as dem hand over di first seven of di 20 surviving captives to Red Cross people for Gaza on Monday. Dis move bring big joy for Tel Aviv as plenty people gather for support di families wey dem hold hostage. Di handover na part of ceasefire wey US President Donald Trump broker after two years fight, and Hamas suppose release all hostages […]

todayOctober 13, 2025 22

Entertainment

Peter Okoye Vex As US Waitress Enter Him DM Say Tip Too Small

Peter Okoye don para after one waitress for US restaurant enter him DM to blast am over di tip wey e drop. Tori be say di singer spend $1000 chop for di restaurant, but na only $60 tip e leave. Di waitress vex come yarn say na dis kain small tip and other wahala make many people no dey like Peter again. Peter no keep quiet, e snap di message […]

todayOctober 13, 2025 21

Sports

Ancelotti Dey Ready To Make World Cup History With Brazil

No country ever win World Cup wit foreign coach before, but Carlo Ancelotti talk say “first time dey for everything” as e dey plan make history with Brazil. Di Italian become Brazil first coach wey no born for dia own country in 60 years when e start in May, and e help di five-time champions secure dia ticket for next year World Cup. Brazil go face Japan for friendly match […]

todayOctober 13, 2025 20

Sports

NPFL Wahala: Teargas Fly After Pillars, 3SC Draw

Di Nigeria Premier Football League enter spotlight for wrong reason on Sunday as Shooting Stars’ late equaliser cause gbege for Sani Abacha Stadium, Kano. Di high-tension Matchday 8 clash end 1–1, but na afta final whistle wahala start. Some Kano Pillars fans vex enter pitch, attack match officials and Shooting Stars players. Di match bin start well for Pillars as Mustapha Jibrin score early for 9th minute, but Adams Mustapha […]

todayOctober 13, 2025 24

Sports

Late Joe Erico Comot Cloth, Curse Super Eagles – Oliseh Yarn

Former Super Eagles midfielder and captain, Sunday Oliseh, talk say late coach Joe Erico comot him cloth nack naked and curse Nigeria national team after e feel say dem betray am during di 2002 World Cup waka for Japan and South Korea. Oliseh yan dis one for him recent talk on Home Turf Podcast, where e also suggest say di curse fit be reason why Nigeria dey struggle for big […]

todayOctober 13, 2025 20

International

China Man For Die, But Pig Liver Save Am For 170 Days

Doctors for China don score big win for science as dem report say one 71-year-old man live 171 days after dem transplant gene-edited pig liver give am. Di pig liver stay for him body for 38 days, dey work well as support system, na di first time wey pig-to-human liver transplant go enter peer-reviewed journal. Dem do di surgery for May 2024 for First Affiliated Hospital of Anhui Medical University, […]

todayOctober 10, 2025 45

Sports

Mahrez Lead Di Charge As Algeria Dust Somalia 3-0

Ex-Manchester City and Leicester winger, Riyad Mahrez, show say e still dey fire as e provide cross wey Mohamed Amoura volley enter early, then bang him own rising half-volley for 19th minute. Mahrez wey captain di team play mind game with him marker before e create di third goal for Amoura 12 minutes into second half, after which dem both comot. Algeria almost add another goal from Youcef Belaili, but […]

todayOctober 10, 2025 16

Entertainment

“I Fit Fail As Musician, But Not As Papa” – Adekunle Gold

Nigerian singer, Adekunle Gold, don pour him heart out as he reveal say na him wife, Simi, and dia daughter, Adejare, dey run things for him life now. Di music star yarn dis one for NotJustOk podcast, where he talk say him number one mission na to give Adejare soft life wey go beta pass wetin him hustle through as pikin. According to am, he no dey ever reason make […]

todayOctober 10, 2025 64

Sports

Mbappé: Madrid Don Reset My Brain, Leg Don Balance

Kylian Mbappé don talk say him move go Real Madrid help am “put head and leg back for ground” and him sharp start to di season show am well. Di France striker don score 16 goals for 14 games for club and country, and e only fail to score for one match since e start him second season for Spain. Even though e take reach January to get same number […]

todayOctober 10, 2025 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app