News-edi 1

1469 Results / Page 18 of 164

Background

National

Palace Aide Stop Woman Shake Olu of Warri Hand

By: Rilwan Agbomeji One viral video don show how an aide to di Olu of Warri, Ogiame Atuwatse III, gently stop one woman wey wan shake di monarch hand for palace lounge. Di 47-second clip wey start trend on Tuesday show di Olu dey waka with im entourage wey dey wear traditional red and white Itsekiri attire. According to palace custom, any subject wey wan greet di Olu no fit […]

todayJanuary 7, 2026 5

Sports

NFF Calm Fear Say Fight Nor Dey Eagles AFCON Camp

By Ebi Oboko Nigeria Football Federation don play down tori say wahala dey for Super Eagles camp for 2025 AFCON for Morocco after small clash happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for pitch. The incident happen during Nigeria 4–0 win against Mozambique for Fez Stadium, as Osimhen score two goals while Lookman and Akor Adams add one goal each. Despite the big win, people notice when Osimhen and Lookman […]

todayJanuary 7, 2026 8 1

foreign

Saudi Coalition Fire Bomb for Yemen South

By Ebi Oboko Saudi Arabia-led coalition day never break, early mor mor confamate say, dem don fire bomb scarra Dhale, Yemen, on Wednesday. Say Southern Transitional Council (STC) leader Aidarous al-Zubaidi even jump comot plane wey im suppose use fly, use leg pick race for di mata, and dat up till now nobody know wia im enter. Coalition add say e don gather plenty soldiers, tanks, gun, and munitions for […]

todayJanuary 7, 2026 6 1

National

Jonathan Put Pledge to Join PDP Fight for 2027 Election

By Ebi Oboko Wi Former Presido, Goodluck Jonathan don knack hand for chest say e go dey more active for Peoples Democratic Party matter for 2027 election. Na PDP National Chairman, Tanimu Turaki (SAN) share dis update after private meeting with di  former presido on tuesday. Turaki waka go Jonathan Maitama office with all National Working Committee, some former governors, party founding fathers, and few selected state chairmo say dem […]

todayJanuary 7, 2026 18 5

Lagos

Governor Sanwo-Olu Ginger Lagos Storytellers to Do More

By Ebi Oboko Oga Govo of Lagos, Babajide Sanwo-Olu, omo enter area, don ginger aproko pipo wey be say dia work na to tell story about Lagos, say, make dem no give up, say make dem continue and to also joinbodi with goment to grow the creative economy. The govo dey tuk Dis one on Tuesday for Lens for Good 2026 Storytellers’ Conference wey carry di theme “Stories dat Move […]

todayJanuary 7, 2026 8 2

National

IGP Egbetokun Move DIG Gumel, 17 CPs Go Key Police Posts

By: Rilwan Agbomeji Inspector-General of Police, Olukayode Egbetokun, don deploy Deputy Inspector-General of Police Mohammed Usaini Gumel and 17 Commissioners of Police, suk dem for various departments, commands, and formations for inside di obodo Nigeria. According to di Force tuk, tuk, Benjamin Hundeyin, di deployment na to make police work stronger, improve leadership, protect people well, and give beta service. Under di new arrangement, DIG Gumel go head di Force […]

todayJanuary 6, 2026 8 4

Sports

Anthony Joshua Dey Consider Quit Boxing

By Ebi Oboko Former world heavyweight champion Anthony Joshua say, like dis, dey plan to quit or to continue boxing. According to im uncle, Adedamola Joshua wey conversate dis marra give tori pipo, say, after di tragic car accident for Nigeria wey kill two of im close friends, Joshua tell im family say e wan stop while people still dey greet am. Di uncle tuk say di family sef dey […]

todayJanuary 6, 2026 19 3

Lagos

Governor Sanwo-Olu Do Give away for Lagos Military Veterans

By Ebi Oboko Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don do give away with N100 million, four two-bedroom houses for Ajara, and two pick-up vehicles to Lagos Chapter of Nigerian Legion. Im tuk dis one on Monday during State Executive Council meeting for Lagos House, Ikeja, as part of the launch for 2026 Armed Forces Remembrance Day Emblem. Di Govo say, him dey do dis to remember fallen heroes wey serve […]

todayJanuary 6, 2026 16 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app