News-edi 1

2502 Results / Page 20 of 278

Background

Lagos

Lagos Govt Gbab 12 People Wey Dey Throway Dirty Anyhow

Lagos State Gornment don gbab 12 pipo wey dey dump dirty anyhow for inside Lagos Island, Yaba and Ikorodu. Na LAWMA officials and KAI Corps carry out dis operation as part of gornment plan to wipe out dirty environment and force residents to obey waste management law. LAWMA oga, Dr. Muyiwa Gbadegesin, talk say Project WISE Enforcement Team catch 11 suspects red-handed during surveillance for Lagos Island and YABATECH area […]

todayJuly 16, 2026 11

OBODO NAIJA

20-Year-Old Lady Kpai After Odogwu of Asaba Allegedly Rape Am

Delta State Police Command don arrest popular content creator, Ifeanyi Ogbonna, wey people sabi as "Odogwu of Asaba," over allegation say e rape one 20-year-old woman wey later die for hospital as she dey receive treatment. Police Public Relations Officer for Delta State, SP Bright Edafe, make dis one public for statement wey e post for X on Wednesday. Police tok say dem arrest di 40-year-old Asaba resident after allegation […]

todayJuly 15, 2026 46

Sport Yarns

Ashe Declare Say E Don Set For 2026  Commonwealth Games

By : Jolayemi Olajide Nigeria sprint star, Favour Ashe, don rake to boost moral  say e don ready mentally and physically for the 2026 Commonwealth Games wey go happen for Glasgow, Scotland. Ashe, wey people sabi as "The Nigerian Nightmare," say Team Nigeria training camp  dey hot wetin nor gud and  dat confidence high. Di  100 metres and 4x100 metres relay specialist explain say di training don put the team […]

todayJuly 15, 2026 18

Sport Yarns

Spain Shock France, Enter World Cup Final

By : Jolayemi Olajide Spain don shock World Cup favourites, France, beating dem  2-kondo victory on Tuesday to book dia place for the final of di tournament. Mikel Oyarzabal first-half penalty and Pedro Porro second-half goal naim hellep di European champions secure the win for AT&T Stadium, Texas. Spain, wey win the World Cup for 2010, go now face either Argentina or England for Sunday final in New Jersey.

todayJuly 15, 2026 10

OBODO NAIJA

INEC Back David Mark ADC Leadership, Reject Rival Group for 2027

By : Jolayemi Olajide Independent National Electoral Commission, INEC, don fry mouth clear di air say na only African Democratic Congress, ADC, leadership wey Senator David Mark dey lead dem go recognise to submit candidates for 2027 general election across Nigeria. INEC National Commissioner, Mohammed Haruna, naim go tuk for interview dat dem don give Mark-led leadership access to the nomination portal. Haruna explain say rival faction no get legal […]

todayJuly 15, 2026 10

OBODO NAIJA

Remi Tinubu, Wike Vow To Finish work for Abuja

By : Jolayemi Olajide Nigeria First Lady, Remi Tinubu, and FCT Minister, Nyesom Wike, don promise say dem go press more development for  abuja resident throat. Dem yarn dis one during project commissioning for satellite town, abuja, say government go build beta roads, and  improve public facilities. According to dem, di plan na to make life easier for residents and open more opportunities for businesses to grow.

todayJuly 15, 2026 8

south west

LAUTECH Hospital Release 31 Rescued Oyo School Pupils

By : Jolayemi Olajide LAUTECH Teaching Hospital Ogbomoso don discharge 31 pupils wey dem rescue after kidnappers abduct dem from schools for Oriire Local Government Area of Oyo State. Di hospital Chief Medical Director, Olawale Olakulehin, konfam say di children don pass medical checks and dem don reunite with dia families. Im  explain say na 39 rescued pupils dem admit for di hospital after dia  release, but eight of dem […]

todayJuly 15, 2026 12

south west

IGP Special Squad Nab Fake DG for Osun

By : Jolayemi Olajide Nigeria Police Force special team, on Tuesday, don go  arrest Adeniyi Adeyemi for one place inside Osun State after Federal High Court for Abuja tell olukpa to  arrest am. Adeyemi wey dey call himself Director-General of Presidential Foreign Investment Promotion Council dey face eight-count charge wey include alleged conspiracy, forgery and impersonation. Justice Mohammed Umar order make police arrest am after gornment lawyer, Wisdom Madaki, tell […]

todayJuly 15, 2026 11

Lagos

Bad Smell, dirty Trouble Oshodi As Residents beg gornment for  Action

By : Jolayemi Olajide Residents, traders and commuters for Oshodi, Lagos, don raise alarm say dirty dey smell dem for di area despite baba Govo, Babajide Sanwo-Olu order to increase waste evacuation across di state. New tatafos reach di  Oshodi Bus Terminal area, show plenty dirty dey cover roadside, walkway and part of the road, with bad smell wey dey smell everybodi Some traders complain say di waste don stay […]

todayJuly 15, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds