News-edi 1

2593 Results / Page 240 of 289

Background

National

Blind People Dey Beg For Inclusion, Make Govment Support Dem For Lagos

 Di Nigeria Association of di Blind, Lagos Chapter, don call on govment and everybody for society make dem support people wey no dey see well, by promoting inclusion and making things easy for dem. Dem talk dis one on Wednesday during 2025 International White Cane and Safety Day celebration wey happen for St. Paul Anglican Church, Ilupeju. Di theme na “White Cane, My Identity.” Di association use di event take […]

todayOctober 16, 2025 30

Lagos

From Culture To Cruise – Konfam FM Show Mad Love For Dia Customers

Last week, from Monday, October 6 reach Friday October 10, Konfam FM hold big Customer Service Week to show deep gratitude and celebrate all our correct listeners wey dey everywhere for di world. Dis week na to appreciate una, our beautiful customers wey dey loyal, dey tune in every day. We make di event jolly and lively as we represent different cultures, share better food, gist, and plenty love to […]

todayOctober 14, 2025 66 3

Sports

Oliseh: NFF Chop $1M World Cup Money, No Pay Players

Former Super Eagles skipper and coach, Sunday Oliseh, don open nyash for Nigeria Football Federation (NFF) say dem pocket $1 million wey FIFA send make dem share with players wey hustle qualify Nigeria for di 2002 World Cup, na wetin For one podcast wey dem call Home Turf, Oliseh yarn say him and di federation get agreement to share di money 50-50, $500,000 for NFF and $500,000 for di 30 […]

todayOctober 14, 2025 38

Sports

Cape Verde Be Di Smallest Africa Country Wey Don Enter World Cup

Cape Verde don qualify for FIFA World Cup first time for dia history after dem hammer Eswatini 3-0 for Monday night, secure top spot for Group D of CAF qualifiers and lock dia ticket for 2026 tournament. Dem Blue Sharks, wey be island country with just over 550,000 people for West Africa coast, become smallest African nation by population to ever waka enter football biggest stage. For front 15,000 fans […]

todayOctober 14, 2025 60

Local

Company Yarn Say Demolished Lekki Property No Belong To Ola Of Lagos

One Nigerian company, Skyewise Group, don clear di air say di luxury car lot wey government bulldoze for Lekki-Epe Expressway no belong to auto influencer, Ola of Lagos, like people dey yarn for social media. Na afta videos of heavy machines dey demolish car stands last Saturday go viral, many people begin talk say na Ola of Lagos get di place. But on Monday, Skyewise CEO, Elvis Abuyere, drop official […]

todayOctober 14, 2025 33

International

Madagascar Presido Rajoelina Run As Gen Z Protest Scatter Government

Madagascar Presido, Andry Rajoelina, don jackpa comot di country as Gen Z youths lead heavy protest wey topple di government, opposition leader Siteny Randrianasoloniaiko tell Reuters on Monday. E talk say na on Sunday di man waka, after soldiers join di protesters. “We call di presidency people, dem confirm say he don leave,” Siteny yarn, but nobody sabi where di presido dey now. One military source confam say Rajoelina fly […]

todayOctober 14, 2025 33

National

Naija Don Get 145 Building Collapse Wahala For 4 Years

Nigeria don record about 145 building collapse cases from 2022 to September 2025, with Lagos state dey responsible for half of dem, LEADERSHIP find out. Building Collapse Prevention Guild (BCPG) first talk say between 2022 and 2024, Nigeria see 135 collapse wahala, but for 2025 alone, Lagos get nine and Abuja get one. For just January to June 2025, Lagos alone get eight building collapse wey kill 18 people, from […]

todayOctober 14, 2025 33

National

Enugu Gov Peter Mbah Don Waka Comot From PDP Go APC

Enugu State Governor, Peter Mbah, don officially comot from Peoples Democratic Party (PDP) join All Progressives Congress (APC). He announce am during one state-wide broadcast to Enugu people. Mbah talk say e make sense to waka go APC so dat Enugu fit connect better with central government. E talk say, “There comes always time wey person gats make bold choice to determine im destiny. After plenty reflection, we decide to […]

todayOctober 14, 2025 35

National

ASUU Reject FG No-Work-No-Pay Wahala

Federal government don tell all di vice chancellors for di federal universities make dem follow di “no-work-no-pay” policy for di ASUU strike wey dey happen now. Di Ministry of Education talk say dem no happy as ASUU still dey do strike despite many calls for dialogue. Dem ask di vice chancellors make dem do headcount, report who dey work, and make sure say salary no go pay those wey no […]

todayOctober 14, 2025 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds