News-edi 1

1469 Results / Page 33 of 164

Background

Lagos

Lagos Police Deploy 5,000 Officers, Say Make Dem Tackle Jaguda Boys

By: Rilwan Agbomeji As Lagos dey prepare for chrismas and new year di State Police Comand say dem dey tighten security across di state including di water ways. Say like dis dem don deploy 5000 security officers to make sure say residents and di state dey safe. Na for inside strategic management meeting wey dem do, Police Commissioner,  Moshood Jimoh share di updates say dem don ready dia rake, an […]

todayDecember 24, 2025 7

foreign

Lionel Messi Sister Enter Hospital Afta Car Crash

By: Rilwan Agbomeji No be small thing ooo say Argentine superstar, Lionel Messi sister, Maria, get motor crash and like dis like dis, dem don dey drag her mata inside hospital for Miami. Report say all of a sudden she lose control, jam wall as at di time wey pipo rush reach there, she don already pass out Later aproko pipo report say she break her heel, wrist and get […]

todayDecember 23, 2025 12

foreign

Russia Attack Ukraine, Kill 1 Pikin And 3 Others

By: Rilwan Agbomeji  At least three people don kpai, including one four-year-old pikin, as Russia launch new attacks for Zhytomyr region and other parts of Ukraine. According to Ukraine Energy Ministry, Plenty pipo wunjure as Russia target energy facilities across di country. Emergency power cuts don start for some areas, including Kyiv and nearby regions, to manage di gbege.

todayDecember 23, 2025 6

National

US Open Door Launch Immigration Plan

By: Rilwan Agbomeji US Department of Homeland Security don announce new plan wey go pay $3,000 to migrants wey waka go by themselves. Any undocumented migrant wey register through CBP Home app before end of year go fit collect di cash plus free flight back home. DHS talk say dem go still forgive any fines or penalties wey migrants dey owe for not comot earlier. Di programme get limited-time offer […]

todayDecember 23, 2025 7

Sports

Troost-Ekong Collect National Honour Certificate From Presido Tinubu

By: Rilwan Agbomeji  Retired Super Eagles captain William Troost-Ekong don receive national honour certificate from Presido, Bola Ahmad Tinubu on Monday. Troost-Ekong announce di receipt for X on Tuesday, say e dey proud for im and im family. Di award na Member of di Order of di Federal Republic (MFR), wey Tinubu giv am for official ceremony. E thank President Tinubu for di honour, call am big recognition for im […]

todayDecember 23, 2025 11

National

Six Rivers Reps Kawasaki Go APC

By: Rilwan Agbomeji Based on di gbege wey dey inside di People’s Democratic Party, anoda set of PDP law makers precisely from Rivers State don buy waka enter di All Progressives Congress. Dis announcement follow di law makers sitting on Tuesday for Abuja. Di law makers include Solomon Bob, Victor Obuzor, Dumnamene Dekor, Cyril Hart, Blessing Amadi and Felix Nwaeke. According to source from di National Assembly, all six of […]

todayDecember 23, 2025 6

Lagos

Sanwo-Olu Swear In Obasa Pikin As Agege LG Chairman

By: Rilwan Agbomeji Lagos Govnor Sanwo-Olu on Monday for Lagos House, Ikeja, swear in Abdul-Ganiyu Obasa as Agege Local Govment chairman. Sanwo-Olu tell am make e face grassroots work and follow Lagos govment plan. Obasa wey be son of Assembly Speaker Mudashiru Obasa bin don dey act as chairman before dem confirm am. Dem also swear in Toyin Adejimiwa as Permanent Secretary same day.

todayDecember 22, 2025 10

National

FG Yarn Say Palava With US Don Clear Well-Well

By: Rilwan Agbomeji Federal Govment don talk say di gbege wey burst between Naija and America don settle well-well. Information Minister Mohammed Idris yarn dis one on Monday for year-end briefing for Abuja. E say Naija handle di mata wella and di talk help both countries lock hands stronger. Di palava start afta US President Donald Trump threaten action over alleged killing of Christians for Naija, but FG say issue […]

todayDecember 22, 2025 8

Sports

Zambia Carry Last-Minute Draw Against Mali For AFCON 2025

By: Rilwan Agbomeji AFCON 2025 Group B take enter stage on Monday Afternoon as Zambia and Mali take play 1-1 draw. Mali start sharp from kickoff and create plenty chances, but El Bilal Touré miss big penalty for 41st minute. For 60th minute, Mali finally score when Lassine Sinayoko finish clean from corner move. Zambia no gree loss, Patson Daka later score one mad equalizer wey carry di game enter […]

todayDecember 22, 2025 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app