News-edi 1

2593 Results / Page 34 of 289

Background

Sport Yarns

How Flamingos take  Fly Enter 2026 U-17 Women World Cup

Edited by Ebi Oboko Nigeria U-17 women team, di Flamingos, don qualify for 2026 FIFA U-17 Women's World Cup after dem beat Benin Republic 5-3 for second leg in Lomé, Togo. Di victory give Nigeria 8-5 aggregate win and secure one of Africa qualification tickets for di tournament. Queen Joseph shine well with hat-trick, while Mary Akpan Dunstan and Esther Enne Stephen also score for di Flamingos. Di 2026 FIFA […]

todayJuly 12, 2026 20

National

President Tinubu Give Kudos to Security Agencies Over Oyo School Pikins Rescue

Edited by Ebi Oboko Wi oga Presido, Bola Tinubu don express joy as security agencies rescue di school pikin dem and teachers wey kidnappers hold for 56 days for Oriire community, Oyo State. Baba Seyi  hail di military, DSS and Nigeria Police for di successful operation wey lead to di arrest of eight suspected kidnappers while security operatives neutralise oda gang members. Tinubu also sympathise with di victims and dia […]

todayJuly 11, 2026 27 3

obodo oyinbo

Trump Raise Alarm, Warn Iran Not to Try Nonsense

Edited by Ebi Oboko US Presido,  Donald Trump don warn say America go completely destroy Iran if dem try say naim him Iran dey target for  office to Kpai. Trump write for him Truth Social page say plenty missiles don ready and di US military don receive order to respond if any attack hapun. According to am, di military fit launch massive operation against Iran and continue am for one […]

todayJuly 11, 2026 24 3

National

Tinubu, Shettima to Fly APC Flag for 2027 Election

Edited by Ebi Oboko All Progressives Congress, APC, don officially retain Vice Presido, Kashim Shettima as running mate to wi oga  Presido,  Bola Tinubu for di 2027 presidential election. Di party don submit di names of Tinubu and Shettima as dia presidential candidates for di poll. APC National Publicity Secretary, Felix Morka, tok say di party get confidence say e go win and remain for power after di 2027 general […]

todayJuly 11, 2026 23

Sport Yarns

Spain Knock Belgium Out, Set for France Showdown

Edited by Ebi Oboko Spain don beat Belgium 2-1 to qualify for the World Cup semi-final, where dem go face France. Fabian Ruiz score first for Spain before Charles De Ketelaere equalise for Belgium before halftime. Mikel Merino later score di winning goal after Belgium substitute goalkeeper Senne Lammens fumble the ball. Spain now don set big semi-final clash with France and Kylian Mbappe for Tuesday.  

todayJuly 11, 2026 29 7

OBODO NAIJA

Ajibade, Oshoala Lead Super Falcons Squad for WAFCON

Super Falcons coach, Justine Madugu, don release 25-player squad wey go represent Nigeria for 2026 Women Africa Cup of Nations for Morocco. Captain Rasheedat Ajibade, goalkeeper Chiamaka Nnadozie and striker Asisat Oshoala dey among di players wey go defend Nigeria continental title. One big surprise for di list na say defender Ashley Plumptre no make di final squad despite her strong performance for di team before. Nigeria, wey don win […]

todayJuly 11, 2026 26 3

Sport Yarns

Sinner, Zverev One Match Away from Wimbledon Glory

Jannik Sinner don beat Novak Djokovic straight sets 6-4, 6-4, 6-4 to qualify for di Wimbledon final and stop di Serbian legend from chasing him 25th Grand Slam title. Alexander Zverev too nor waste time as e brush aside British wildcard Arthur Fery 7-6, 6-2, 6-4 to book him own place for di final. Now, Sinner and Zverev go face each other for Sunday to battle for di Wimbledon trophy.

todayJuly 11, 2026 20 3

OBODO NAIJA

Imo Govo Uzodimma Greet Oyo Families as Kidnap Victims Regain Freedom

Imo State Governor, Hope Uzodimma, don hail wi oga  Presido Bola Tinubu and security agencies over di successful rescue of di school pikin dem and teachers wey bandits kidnap for Oriire, Oyo State. Im put dis one for statement say di operation show say Federal Gornment dey serious about protecting Nigerians . Uzodimma express joy say all di victims reunite with dia families after 56 days for captivity without any […]

todayJuly 11, 2026 25

south west

Makinde Raise Alarm Over Governors’ Limited Power on Security

Edited by Ebi Oboko Oyo State Govo, Seyi Makinde, don complain say pipo dey always blame state gofrnors anytime insecurity hapun, even though constitution nor give dem power to control security agencies. Makinde tok dis one on Friday after closed-door meeting with Bauchi State Govo, Bala Mohammed, and APM National Chairman, Yusuf Dantalle. According to am, dem discuss security, governance and political matters ahead of di 2027 general elections. E […]

todayJuly 11, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds