News-edi 1

1477 Results / Page 42 of 165

Background

Lagos

Lagos Govment Say No Structures Wey Dey Under High-Tension

By: Rilwan Agbomeji Lagos State government tire shirt oh say say dem go begin remove any building or structure wey people build under high-tension wire because e dey dangerous for residents. Na for inspection waka wey dem go do for Third Mainland Bridge area, Special Adviser Olajide Babatunde  yarn dis one as im see plenty shanty and illegal structures wey no suppose dey di 50-metre right-of-way, im belle even turn […]

todayDecember 9, 2025 11 2

National

Senate Say Yes To Tinubu, Army Benin Republic Waka

By: Rilwan Agbomeji Wi Senate sharpaly do gree for wi oga Presido Bola Tinubu to carry Nigerian troops enter Republic of Benin, dem nor even stress am or do yanga say dem wan help restore peace. Oga senate Presido Godswill Akpabio announce di approval on Tuesday during plenary afta dem check Tinubu letter for Committee of di Whole according to Section 5, Part II of Constitution. Lawmakers join bodi vote,  […]

todayDecember 9, 2025 7

National

Atiku Yarn Matas Say Late Yar’adua Still Dey Inspire Naija

By: Rilwan Agbomeji Wi former vice-presido Atiku Abubakar betterlicious don thruway salute give wi late general,  Shehu Musa Yar’adua, say im still dey inspire politics for Naija. Im dey yanyanpu dis one for Abuja for inside union gathering, Atiku yarn say Yar’adua na correct mentor, brother-in-arms, and moral compass wey dey guide people even till now. Di former vice presido say,  Yar’adua legacy dey motivate Nigerians wey still dey believe […]

todayDecember 9, 2025 7

National

Reps Tell NNCPL To Drop 2021 Audit Papers Dec 15 For Audit

By: Rilwan Agbomeji House of Reps Public Accounts Committee don claer marras dat make di  nnpcl  drop all di missing documents  of company and show face for Abuja before December 15, 2025, over  2021 spending audit wahala. Chairman Bamidele Salam vex for Monday sitting as e blast NNPCL for always dodging summons and refusing to bring di papers wey dem ask for. E talk say di kain disrespect wey di […]

todayDecember 9, 2025 10

International

Prime Minister Starmer Join Tiktok Dey Do Tap Tap

By: Rilwan Agbomeji Britain Prime Minister, Keir Starmer, don launch im TikTok account on Monday to connect with younger voters, even though gorment  no dey allow to use di app for uk. Wey tori pipo con ask say na whole prime mister dey do tap tap, Na im tok tok person dey clear di matter that, na for  security measures, say nor be tap tap di Starmer dey do for […]

todayDecember 9, 2025 12 1

Sports

Nwabali Chance To Play For Afcon 2025 Dey Shakibala Cause Of Wunjuri

By: Rilwan Agbomeji Tori dey fly fly down and up  say Super Eagles keeper, Stanley Nwabali, fit miss AFCON 2025 as im still dey battle ankle and hand Wunjury. Chippa United coachie, Vusumuzi Vilakazi, na carry marras for hea dey yanyanpu  give tori pipo say,  Nwabali get wunjury. Vilakazi talk say na during Nigeria World Cup playoffs for Morocco last month e worsen di injury, and since e come back, […]

todayDecember 9, 2025 11

International

TikTok Lock Night LIVE For Naija

By: Rilwan Agbomeji TikTok don announce say dem go block Nigerians to dey use  LIVE late-night as from Sunday midnight, and na part of one serious safety investigation wey dem dey run. Plenty creators see in-app notice wey tell dem sharp-sharp say from 11pm reach 5am, LIVE don waka disappear and anybody wey try enter go just meet “No Access.” Di move shock users because even LIVE shows from other […]

todayDecember 8, 2025 14

Sports

Guardiola Ginger Im Boys To Stay Gallant Against Real Madrid

By: Rilwan Agbomeji Pep Guardiola don warn im Man City boys ahead of Wednesday Champions League clash with Real Madrid, say Bernabeu no be playground. E talk dis one afta City beat Sunderland 3–0 for Premier League, remind everybody say Madrid no be team you dey joke with. Even though Madrid just chop 2–0 to Celta Vigo, Guardiola yarn say Bernabeu fit humble any big team wey no shine eye. […]

todayDecember 8, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app