News-edi 1

419 Results / Page 42 of 47

Background

National

BREAKING: Nigerian Government Increases Passport Fees

Federal Government don announce say dem go increase the fees wey Nigerians dey pay to get passport. The new prices go start from September 1, 2024. Na wetin the spokesman for Nigeria Immigration Service, A.S. Akinlabi, talk for one statement wey e release on Thursday. Akinlabi talk say the new increase na to make sure say the Nigerian Standard Passport wey go start from September 1, 2025, get better quality […]

todayAugust 28, 2025 8

Sports

Transfer Update: Wolves Dey Eye Super Eagles Striker Arokodare

Premier League side Wolverhampton Wanderers dey for advanced talk to sign Nigerian striker Tolu Arokodare from Belgian club Genk. Wolves ready to put down €25 million bid for the 24-year-old forward wey dem expect to comot from Jupiler Pro League before this summer transfer window close. Arokodare, wey be last season top scorer for Belgium with 21 goals, don also attract interest from big Serie A clubs AC Milan and […]

todayAugust 28, 2025 17

Entertainment

“My miracle don land” – Media person Toke Makinwa welcome baby girl

Toke Makinwa, wey be media person and actress, don welcome her baby girl. Toke Makinwa show say she dey pregnant before and she share her happiness with fans. She use one creative way talk the gender of her pikin by doing pink-themed gift unboxing for her Instagram page. The actress come share the happy news for her Instagram on Thursday, where she talk how she dey happy and thankful. Toke […]

todayAugust 28, 2025 23

Local

Anybody Wey Assault VIO No Go Escape Punishment – Lagos Government

Lagos State Ministry of Transportation don talk say dem no go allow the people wey assault Vehicle Inspection Officers (VIO) for Mile 2, as dem dey carry out dia lawful duty, go scot-free. Dem say serious punishment go follow the attack. The Commissioner for Transportation, Mr. Oluwaseun Osiyemi, talk dis one for one statement wey e release on Thursday for Lagos. According to him, “We hear with serious vex say […]

todayAugust 28, 2025 11

Local

No Be Loan We Want – Taraba University ASUU Tell FG, Say Make Dem Give Dem Entitlements

The Academic Staff Union of Universities (ASUU), Federal University Wukari (FUW) branch, don demand say make government pay all their entitlements wey don pile up, dem reject the new loan scheme wey Federal Government bring. The union talk this one during protest wey dem organize to show how dem dey unhappy because government never do wetin dem promise for long time. ASUU FUW Chairperson, Professor Asabe Mercy, wey lead the […]

todayAugust 28, 2025 3

Lagos

Police Don Declare Abiodun Ariori Wanted for Owode Onirin, Say Everywhere Don Calm Now

According to statement wey the command PPRO CSP, Benjamin Hundeyin release, the CEO of Prosperous Ariori Golden Venture Limited, Abiodun Ariori, dey wanted for connection with killing of three people, plus injury wey one police Inspector suffer, and dem talk say the Inspector life still dey in danger. The Commissioner of Police for Lagos State Command, CP Olohundare Jimoh, lead one combined police team wey get personnel from the Command […]

todayAugust 28, 2025 26

National

Strike Dey Loom: ASUU, VCs Vex say Professors Dey Collect Only ₦525,000 Every Month

ASUU don finish dia nationwide protest wey happen on Tuesday, and dem members dey prepare now to hold congress for inside campuses to decide wetin dem go do next. Dis na as Federal Government dey hold meeting today to try solve di long wahala wey dey ground since about di 2009 agreement between dem and ASUU wey dem don renegotiate but never implement. Earlier dis year, Tinubu government bin release […]

todayAugust 28, 2025 6

Politics

2027: APC Open Door Make Anybody wey Get Liver Contest Against Tinubu

The All Progressives Congress (APC) don talk say even though plenty people don endorse President Bola Tinubu for second term, other people wey dey inside di party and wan contest for president in 2027 still fit try their luck. APC National Organising Secretary, Sulaiman Argungu, talk dis one on Wednesday for one news session with journalists for party headquarters for Abuja. He talk say di party leadership including di National […]

todayAugust 28, 2025 10

National

Mosque Attack: Wetin I See Break My Heart – Katsina Gov Talk

Governor Dikko Umaru Radda wey dey rule Katsina State don waka go Mantau Village for Malumfashi Local Government Area to go sympathise with di people wey bandits attack for mosque, where dem kill 32 people wey dey pray. Di attack happen for midnight last week Tuesday. As Governor reach di village, him talk say government go give ₦500,000 to each family wey lose person or suffer for di attack. Di […]

todayAugust 28, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app