News-edi 1

2593 Results / Page 41 of 289

Background

Lagos

LASEPA Lock Club And Hotel For Lagos Over Heavy Noise

Environmental agency for Lagos State, LASEPA, don cut chain follow one nightclub and hotel, say dem one use obule dey blind neighbours ear. Small tin, obule, obule, obule, ahoo Di two places wey dem seal on Monday dey for Olowora and one Suites inside Alapere, Ketu. According to di statement wey di agency post for X on Tuesday, dem warn dem about niose population but di obule just dey enter […]

todayJuly 1, 2026 17

Obodo Niger

US Supreme Court knock Trump, rule say birthright citizenship must stay

By : Jolayemi Olajide Omo blow, blow don burst, dat  United States Supreme Court don block Presido, Donald Trump order wey bin wan end birthright citizenship for US soil. This judgment na big slap for Trump face as e dey try change  immigration law for  America. U sabi say, When Trump enter office on January 20, 2025, E sign one executive order, say if any parent go born for America […]

todayJune 30, 2026 15

Sport Yarns

Canada, Paraguay, Morocco and Brazil  qualify for Round of 16, 2026 world cup

By : Jolayemi Olajide Chale, like dis, four  teams don enter the Round of 16 for the 2026 FIFA World Cup after dem win dia opening Round of 32 matches. As at Tuesday morning, Canada, Paraguay, Morocco, and Brazil don match forward to di round of 16 Canada naim  first move on Sunday after dem beat South Africa 1-0, before Paraguay and Morocco use penalty shootout arrange dia ticket on […]

todayJune 30, 2026 13

Sports

How Germany Disgrace Dia Village Pipo For World Cup

Germany don do surprise crash out of di World Cup afta Paraguay beat dem 4-3 for penalty shootout, say both teams play 1-1 for regulation and extra time on Monday. Julio Enciso naim score first for Paraguay before Kai Havertz equalise for Germany with im third goal of di tournament. VAR con cancel Jonathan Tah extra-time goal, as Paraguay hold strong reach penalty shootout. Goalkeeper Orlando Gill save two German […]

todayJune 30, 2026 12

obodo oyinbo

US military Rush Open Port For Aid

US military like dis dey fire doings to reopen one major port for La Guaira, Venezuela, to hellep rescue pipo after ejima earthquakes wire di country last week. Five days after di quakes level, whole blocks of buildings, like dis na family members dey cry blood say di don kpai over 1,700 pipo and thousands still dey miss. One temporary matuary inside di port area full with deadibody Forensic doctors […]

todayJune 30, 2026 31

OBODO NAIJA

Federal Gorment Make Change For Nysc

Di Federal Executive Council don approve big change  for National Youth Service Corps (wey wi sabi as NYSC), na di first ogbonge change for since e start 53 years ago. FEC order di Attorney-General and Ministry of Youth make dem amend di NYSC Act so all di new changes fit start immediately. Wetin be di change, Under di new arrangement, civilian go lead NYSC operations while military go still dey […]

todayJune 30, 2026 21

OBODO NAIJA

Tinubu Commission Open New Road For Abuja

Wi oga Presido, Bola Tinubu, don rake full newspaper again say im gorment dey deliver beta development to Nigeria Im yarn dis one through im Vice, Kashim Shettima wey go represent am for di event, commison road project for Karu, wi decision headquarters. Tinubu rake oh, say im road project na blood tonic to   local businesses and e dey  bring development.

todayJune 30, 2026 17

Lagos

Bus Conductor Allegedly Nack LASTMA Screwdriver

Nor be small tin oh, say One bus conductor don go allegedly nack LASTMA official screwdriver for im head, wunjor am yangayanga for gorun for Abule-Egba, along Lagos-Abeokuta Expressway. LASTMA tuk,tuk, Adebayo Taofiq, na him bin sorosoke dis mata inside statement wey dem wrap like akara on Monday. Im explain dat di LASTMA official just bin dey do im job, na dis conductor wey head shake enter argument am, an […]

todayJune 30, 2026 23

Lagos

Lagos Taskforce Begin Clear Alaba Rago, Clear Illegal Traders

Lagos State Taskforce don begin park pipo comot for Alaba Rago area along Mile 2 - Badagry Expressway after dia 72-hour notice wey dem give illegal traders and occupants expire on Monday. Dem dey remove street traders, funny shops and every structure wey block road, pedestrian walkway, road median and setback wey break Lagos environmental and town planning law. Chairmo of the Taskforce, CSP Adetayo Akerele, fry mouth, konfam say […]

todayJune 30, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds