News-edi 1

1479 Results / Page 46 of 165

Background

National

Edo Assembly Don Drag 2Baba Wife Come Over Marital Gbege

By: Rilwan Agbomeji Edo Assembly don call Natasha Irobosa, Egor lawmaker, make she run go Ethics Committee within one week afta her gbege with 2Baba dey trend hot hot for everywhere. Speaker Blessing Agbebaku tok say wetin 2baba babe do dey disgrace House name and she gats clear herself. Di whole mata don turn hot gist for TV and social media.  Assembly yarn say members suppose dey behave well, no […]

todayDecember 3, 2025 11

Lagos

Lagos Govt Don Arrest 20 Street Beggars For Ketu, Mile 12

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Government on Tuesday arrest 20 street beggars during enforcement for Ikosi Ketu and Mile 12 areas. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, talk say di operation na part of government plan to restore order and make sure public spaces dey used responsibly and safely. Wahab explain say KAI operatives carry out di latest enforcement around Ketu, Mile 12, Ikosi Road and di […]

todayDecember 2, 2025 21 2

Lagos

Lagos Govt Don Seal Yakoyo Abula Joint For Dirty Wastewater Dumping

By: Rilwan Agbomeji Di Lagos State Wastewater Management Office don seal Yakoyo Abula Joint Restaurant for Victoria Island because dem dey pour untreated wastewater and oil inside public drainage. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, reveal di action for im X handle. Dem shut down di restaurant on Tuesday morning afta officials see say dem dey deliberately discharge dirty water wey don block drainage and fit cause waterborne […]

todayDecember 2, 2025 10

foreign

UK PM Starmer – China Na Big Security Wahala, But Trade Still Dey

By: Rilwan Agbomeji UK PM Keir Starmer don yarn say China na gbege wahala for UK security, but im still talk say dem no fit chop Beijing belle, because money and business no dey play. Na for Monday night meeting im yarn am sharp, drag di old Conservative government say dem sidon sleep make UK–China mata turn complete yawa, with espionage gist dey scatter everywhere. Starmer remind everybody say since […]

todayDecember 2, 2025 6

Sports

Salah Go Bounce Enter Egypt Camp Dec 15 – Slot

By Rilwan Agbomeji Liverpool oga Arne Slot don burst confirm say Mo Salah go waka comot Anfield go link up wit Egypt for AFCON on December 15. Slot drop di tori before Liverpool face Sunderland, yarn say na FIFA order say December 15 na di final day wey club must release players. Egypt sef no dey dull dia AFCON camp don open and dem get friendly match wit Nigeria on […]

todayDecember 2, 2025 8

Sports

Maresca Talk Say Palmer Ready To Jam Leeds

By: Rilwan Agbomeji Chelsea Oga, Enzo Maresca don open mouth say Cole Palmer dey fit and ready to jam Leeds United for Elland Road dis Wednesday wey dey come. Maresca yarn say Palmer dey try gain im full fitness back, but di plan na to push am small-small until e fit run full 90 minutes like before. Di coach add say everybody dey okay, but Romeo still dey recover and […]

todayDecember 2, 2025 5

National

Bandits Don Waka Adamawa Community For Sokoto, Burn Houses and Shops

Bandits don bring dia werey come anoda attack for Adamawa community for Kalgo Ward, Sabon Birni LGA, Sokoto State, dem even burn three houses and one shop, dey waka waka dey put fear for pipo mind up and down. Di gbege burst yesterday night, but We thank God say dem no carry and kill anybody as dem dey do dia yeye operation. Among di house wey dem burn na dat […]

todayDecember 2, 2025 10

National

Northern Govs Wan Lock Mining For 6 Months, Scatter Ground With ₦228bn Security Cash

Govos and Traditional Rulers for north don form geng enter meeting for Kaduna, order say make mining stop for at least six months, and dat illegal mining, na im dey cause all di katakata of security for di North. Di leaders dey para say dat pipo dey face serious gbege wit Jaguda boys and so don set up regional Security Trust Fund, wey every state and local gornment go drop […]

todayDecember 2, 2025 10

Sports

We Go Block Osimhen Goal – Skriniar

Fenerbahce captain, Milan Skriniar don fire warning shot, talk say dem ready lock Victor Osimhen completely as di Istanbul derby go burst tonight for RAMS Park. Galatasaray dey top table with one point, and dis match don turn full-blown city war as both sides dey ginger for supremacy. On top post for X, Skriniar yarn say Osimhen and Icardi fit be hot strikers, but tonight, Fenerbahce dey come rugged, compact […]

todayDecember 1, 2025 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app