News-edi 1

2345 Results / Page 47 of 261

Background

OBODO NAIJA

Court throwey case to block Goodluck Jonathan from 2027 election

By : Jolayemi Olajide Federal High Court for Abuja don throwey di case wey some pipo file to stop former Presido Goodluck Jonathan not to enter the 2027 presidential election. The court say di case na total waste of time and mouth-wash.Because of this one, the judge order the person wey carry the case come make he pay Jonathan N21 million for all di stress. As if dat one no […]

todayMay 26, 2026 15

OBODO NAIJA

 Police and local hunters kpai three kidnappers, rescue victim for Oyo State

By : Jolayemi Olajide Oyo State Police Command don tuk say dem Rambo style kpai three suspected kidnappers and rescue one person wey dem bin kramp for Otu area inside Oke-Ogun axis. Di police tuk, tuk, DSP Ayanlade Olayinka, clear dis one for statement wey im release on Tuesday. Dem talk say the heavy operation hapun after local hunters call dem for help on Monday, May 25, 2026, when the […]

todayMay 26, 2026 10

obodo oyinbo

Naija and Türkiye Sign Big Deal to Take Mining to Next Level

By : Jolayemi Olajide Naija and Türkiye don sign fresh agreement for Istanbul to join hand work for solid minerals and mining mata. Nigeria Minister of Solid Minerals Development, Dele Alake, naim use im yamchop mouth break di news say Baba Tinubu support di movement. Alake say di country don ready to work with the Turkish gornment to change how they dey manage mining, train pipo, and bring beta development. […]

todayMay 26, 2026 11

OBODO NAIJA

Tinubu salute Muslims for Eid, say goment dey work round di clock to fix Naija

  By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido, Bola Tinubu don assure Nigerians say all the reforms wey im goment dey do go continue and dat im dey mout mehn to handle security, steady economy, and progress. Inside im 2026 Eid-el-Kabir message wey comout on Tuesday before Wednesday celebration, baba Seyi salutate all Muslims for Nigeria and across di world. Tinubu talk say true-true, im know say some areas still […]

todayMay 26, 2026 15

obodo oyinbo

How Israel Heavy Bombing Kpai 11 Pipo For Lebanon

By : Jolayemi Olajide Israeli air strikes don go kpai at least 11 pipo and wound 15 others inside eastern Lebanon, as the small peace agreement between them dey face big trouble.The attack block di village of Mashghara inside Bekaa Valley on Monday night, and Lebanon government news konfam say everywia scatter.Prime Minister Benjamin Netanyahu tuk say im give order make army drop heavy bomb join after Hezbollah pipo do […]

todayMay 26, 2026 12

Sports

How 2026 World Cup New Rules Fit Benefit Football

O boy, see as di matter be, di 2026 World Cup wey dey come so, no be small thing o. FIFA don change di game rules kpatakpata to make sure say football sweet, e fast, and everything move correct. Di countdown for football history don enter final stage, e remain just 20 days make ball start to roll for June 11, 2026. Dis World Cup fit change di way wey […]

todayMay 25, 2026 36 5

Entertainment

Advanced Metastatic Kidney Cancer: “Wetin Alexx Ekubo Death Teach Us About Our Health”

One kain heavy silence dey always enter house anytime sickness land, di laugh wey dey burst everywhere go begin reduce, pipo go dey talk low-low, plans and dreams wey dey fly high go begin drag leg, even money wey plenty reach mountain go suddenly look like ordinary paper. For dis life, many pipo dey kill body pursue money, dem go wake before cock crow, suffer traffic, skip food, ignore body […]

todayMay 25, 2026 22

Sport Yarns

Messi Injury Scare Argentina Fans Before World Cup

By : Jolayemi Olajide Lionel Messi don raise fresh injury fear, after e ask make dem substitute am during Inter Miami match against Philadelphia Union for MLS on Sunday. Di Argentina captain hold di back of him left leg before comot for the game in the 73rd minute during di rain-soaked match for Miami. Even though Messi waka comot by himself and enter tunnel without help, fans still dey worry […]

todayMay 25, 2026 16

obodo oyinbo

Pope Leo XIV Warn Say AI Fit Bring Modern Slavery

By : Jolayemi Olajide Pope Leo XIV don call for better control of artificial intelligence, warning say di fast-growing technology fit create new forms of slavery if dem no handle am well. For him first encyclical titled “Magnifica Humanitas,” di Pope warn against di global race to build more powerful AI systems just for political and business dominance. He present di document for Vatican alongside AI experts including Christopher Olah, […]

todayMay 25, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds