News-edi 1

2593 Results / Page 48 of 289

Background

obodo oyinbo

Middle East Peace Deal Dey Shake, Israel Resume Heavy Fight

Fresh tension don rise again for Middle East as Israel and Hezbollah exchange heavy attacks for Lebanon on Friday. According to report, di new peace deal between Iran and di United States dey shake. Tuks wey America and Iran suppose hold for Switzerland, dem don postpone am dafter Iran chief negotiator talk say dem no go shift from dia position and dat dem ready oh to take action. Di peace […]

todayJune 19, 2026 19

Local

NANS and FUOYE VC Hold Heavy Talk

Presido of Nigeria association of Nigerian Student, Akinteye Babatunde, don cut chain oh , say why di Vice-Chancellor of Federal University Oye-Ekiti (FUOYE), Prof. Abayomi Fasina, go suspend di school SUG Presido, James Adio. Babatunde tell pipo on Friday say di student body kick completely against how di school take suspend and push di SUG leader for corner. Di Vice-Chancellor come explain wetin cause di suspension, say Oga SUG presido […]

todayJune 19, 2026 26

Lagos

How Lagos State Police Go Gbag Fake Kidnap Victims

Lagos State Police Command don do small ji mike gbab 26 fine-boys and fine-girls from other countries including some camerounians wey con fake dia kidnap. According to di police, na one 22-year-old Cameroonian woman carry report go police station say dem kidnap am, afta she travel come Nigeria to see one 39-year-old Chadian man wey she dey date for internet. But as police start to dig di dig, ehn, dem […]

todayJune 19, 2026 27

Lagos

Lagos LG Chair Promise to Back Farmers

Alimosho Local Gornment Chairmo, Akinpelu Johnson, don spread joy wetin nor good, dat make farmers wey dey im council nor too worry body oh, say dem ma get support dem. Johnson yarn dis one on Friday for di council secretariat during meeting with All Farmers Association of Nigeria, AFAN, and other agriculture stakeholders for Alimosho, Lagos. According to di Alimosho council chair, farmers get beta role for economic growth, food […]

todayJune 19, 2026 25

Entertainment

Delta Gofnor aide flame Omoni Oboli hot over Alexx Ekubo movie!

By : Jolayemi Olajide Wahala don burst for Nollywood, Omo! One of Delta Governor’s aide, Ossai Ovie, naim carry just carry fire go meet Omoni Oboli. Di reason? Say, Di filmmaker drop her film, 'The First Lady', just few days after dem bury Alexx Ekubo. Even as Omoni talk say she go give all di profit to di family, Ossai no gree. E call the move "pure disrespect," saying she […]

todayJune 19, 2026 14

Sport Yarns

Pochettino tell Messi Sorry, for im papa wey dey hospital

By : Jolayemi Olajide USMNT head coach, Mauricio Pochettino, don message Lionel Messi and im family, after dem rush Messi papa go hospital. Pochettino fry mouth say normal, messi papa, Jorge, receiving treatment for hospital na distraction, but encourage di senior man to stay focus dat im papa go dey alryt. Di former PSG boss, wey sabi Messi well-well, send im full support and best wishes to the family as […]

todayJune 19, 2026 21

Sport Yarns

World Cup Gbege, Police Gbab Ivorian Star Elye Wahi Over Betting Scandal

By : Jolayemi Olajide Nor be small gbege, Ivory Coast striker, Elye Wahi, don enter world cup hot soup. According to report, French police arrest am just two weeks before di  2026 World Cup over alleged spot-fixing. Omo, the gist be say the 23-year-old allegedly collect yellow card on purpose during one Ligue 1 match between Nice and Metz back in May, all just to settle one dirty betting arrangement. […]

todayJune 18, 2026 19

obodo oyinbo

Trump Sign Iran Peace deal for France with Macron Hailings

By : Jolayemi Olajide US President Donald Trump don blast people wey criticize the peace agreement wey e sign with Iran,  say wetin dem dey tuk nor make brain, dat like dis dem dey prepare to sign di deal  for Switzerland. Trump and Iran President Masoud Pezeshkian separately sign di agreement wey go end di Middle East war and reopen di Strait of Hormuz. Trump put im signature for di […]

todayJune 18, 2026 28

Politics

Kingibe Clear Air On Natasha Suspension Report

By : Jolayemi Olajide Somebody shout power, nor be small tin as  Senator wey dey represent FCT for Senate, Ireti Kingibe, drop micro soft word say she nor see di committee report wey lead to the suspension of Kogi Central Senator, Natasha Akpoti-Uduaghan. She yarn this one on Wednesday during interview for tv sit down tuk. According to am, she bin dey attend tax reform retreat when di Senate  consider […]

todayJune 18, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds