News-edi 1

1370 Results / Page 81 of 153

Background

International

Over 85 People Don Die As Heavy Flood Scatter Philippines

At least 85 people don die and hundreds of thousands don run comot from dia houses as one of di strongest typhoon wey hit dis year, Typhoon Kalmaegi, don scatter many towns for central Philippines, according to authorities. According to reports, di heavy storm flood entire towns for Cebu Island, wey be di most populated area, and about 49 people die for there. Government still dey look for 75 missing […]

todayNovember 6, 2025 6

Sports

“Uganda Coach No Send Naija Stars Ahead AFCON Clash”

Uganda national team head coach, Paul Put, don yarn say im boys no dey fear Nigeria or any team for di upcoming 2025 AFCON wey go happen for Morocco from December 21, 2025 to January 18, 2026. Di Cranes land inside Group C with Nigeria, Tunisia and Tanzania, and di Belgian coach talk say even though di Super Eagles don win di cup three times, Uganda go still give dem […]

todayNovember 6, 2025 13

Sports

CAF Don Expand WAFCON To 16 Teams

CAF on expand WAFCON to 16 teams as Morocco set to host 2026 edition. Di Confederation of African Football (CAF) don increase di number of teams for Women’s Africa Cup of Nations (WAFCON) from 12 to 16, according to Completesports.com. Di new format go start from di 2026 edition wey Morocco go host. So far, 12 countries including di defending champions Nigeria don already qualify for di tournament. Dem don […]

todayNovember 5, 2025 17 1

Sports

Trent Alexander-Arnold Chop Boos, Suffer Defeat For Liverpool Return

Trent Alexander-Arnold chop boos as Liverpool boss Arne Slot talk say fans no need am to lift team. Liverpool manager Arne Slot don dismiss di talk say Trent Alexander-Arnold entry na wetin help di team cross line for di match. Di Dutch coach talk say e don dey impressed with di atmosphere all through di 90 minutes, even before ball start. According to am, di fans support dem from start […]

todayNovember 5, 2025 7

Sports

Premier League Star Don Face Gun Threat From Football Agent

Tottenham don yarn say dem dey give full support to Destiny Udogie and im family after di club confirm say di Italy defender bin face gun threat from one football agent. According to reports  di matter happen for London on 6th September, where one unnamed Premier League player bin target. Another man too don allege say di same person wey hold di gun bin blackmail and threaten am during di […]

todayNovember 5, 2025 7

Entertainment

Ex-BBN Erica Nlewedim Complain Say People Still Beg After She Help Dem

Ex-BBN Star Erica Nlewedim complain say people no stop to ask more money after she help dem. Reality TV star and actress Erica Nlewedim don yarn say she dey disappointed as people dey take advantage of her generosity. For one post wey she put for X, di former Big Brother Naija housemate talk say everybody wey she don ever give money to out of her kindness dey always come back […]

todayNovember 5, 2025 15

National

Police Arrest Suspected Pirate, Declare Akwa Ibom Monarch Wanted

Police arrest suspected militant for sea piracy, declare monarch wanted for Akwa Ibom. Operatives of di Akwa Ibom State Police Command, join hand with marine hunters, don arrest one suspected militant, Samuel Geoffrey, wey dey allegedly specialize for sea piracy and k!dnapping for Ibaka, Mbo Local Government Area. State Commissioner of Police, CP Baba Azare, yarn journalists for Uyo on Tuesday, November 4, 2025, say di command don start manhunt […]

todayNovember 5, 2025 7

Sports

Ronaldo Go Soon Retire from Football

Cristiano Ronaldo don finally open up say e go soon hang boot as di Portugal and Al Nassr star prepare for di emotional end of im shining football career. Di 40-year-old legend yarn dis one for interview with Piers Morgan Uncensored, where e talk about retirement and life after football. Ronaldo wey don score 952 goals and win plenty trophies talk say di end dey near but e don dey […]

todayNovember 5, 2025 9

Entertainment

“Igbo Don Finish Me” — Omah Lay Don Dey Use Glass Now

Nigerian singer and songwriter, Omah Lay don shock fans with im recent confession about di kind wahala wey im lifestyle don cause for im body. Di “Soso” crooner use im Snapchat take yarn say too much igbo (weed) don affect im health, and e don reach point wey im gatz dey wear eye glass now. For di video wey im post, Omah Lay talk say, “Igbo don finish me. My […]

todayNovember 5, 2025 15 1

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app