News-edi 1

2355 Results / Page 83 of 262

Background

obodo oyinbo

UN Question Di Death Of 3 Indonesian Peacekeepers For Lebanon

All 15 members for UN Security Council don condemn di wahala wey make three Indonesian UN peacekeepers kpai die for Lebanon. Di council tok dis one for join bodi statement, say di incidents happen for UNIFIL area for south Lebanon, including two deadly explosions, as fighting dey go on along di Blue Line between Israel and Lebanon. Dem wish di injured quick recovery, praise all UN peacekeepers wey dey risk […]

todayApril 2, 2026 19

OBODO NAIJA

ADC, PDP, Obi Blast INEC As Dem Drop David Mark, Aregbesola Recognition

Di African Democratic Congress, Peoples Democratic Party, and Peter Obi dey vex wetin nor good for  INEC say dem  remove David Mark, Rauf Aregbesola and some other party leaders from recognition. INEC tuk say dem take dis decision because of court order wey say make dem maintain status quo until dem settle case about David Mark leadership. ADC tuk, tuk Bolaji Abdullahi and PDP own Ini Ememobong say dis action […]

todayApril 2, 2026 17

OBODO NAIJA

Kaduna North, South Join Body To Back Bola Tinubu, Uba Sani For 2027

Former Kaduna Central senator Shehu Sani talk say Kaduna North wey be mostly Muslim and South wey be mostly Christian don join body under one political party for di first time since 1999. E yarn dis one after Imself, Abbas Tajudeen and Sunday Marshall visit Bola Tinubu for Aso Rock. According to am, di unity na because of wetin Uba Sani and Tinubu don achieve, and both North and South […]

todayApril 2, 2026 15

OBODO NAIJA

President Tinubu Change Date For Ogun Airport Inauguration To April 4

Ogun State Gornment don shift di inauguration of Gateway International Airport and other big projects wey dem plan for Thursday, April 2. Dis one happen after Bola Tinubu change di date of im visit to di state. For statement wey Special Adviser to di Governor on Government House and General Services, Babatunde Olaotan release on Wednesday, dem talk say dem don move di event. Now, di inauguration go happen on […]

todayApril 2, 2026 15

Lagos

How Lagos Gorment Wan Shift Pipo From NEPA Light To Solar Power

Lagos State gornment say dem want make pipo begin shift from poor light to solar power for their houses and small businesses. Commissioner for Energy, Biodun Ogunleye,  say like dis dem dey work on  system wey go make pipo pay for solar like how dem dey pay NEPA bill every month. Ogunleye yarn dis one during one solar project launch for Radio Lagos and Eko FM for Ikeja. E explain […]

todayApril 2, 2026 18

obodo oyinbo

Iran Revolutionary Guards Threaten Apple, Google, Tesla If More Leaders Kpai

Iran Revolutionary Guards like dis, don cut chain say if more of dia top Iranian leaders kpai sake of dis war, dem go target big US tech companies like Apple, Google, Meta, Microsoft, Tesla and others. Say dem drop microsoft word for di workers for these companies make dem avoid office starting Wednesday 8:00 pm Tehran time to save dia life. Di Iran guards dey claim say, these companies dey […]

todayApril 1, 2026 13

OBODO NAIJA

House of Rep Pass N68.3 Trillion 2026 Budget

House of Representatives for Abuja don pass di 2026 Appropriation Bill wey go spend N68.3 trillion. According to House Leader Prof. Julius Ihonvbere, say dis budget go favour  development more dan consumption and make capital spending pass recurrent spending for di first time. U sabi say, di approved budget, wey Presido Bola Tinubu propose last year, include over N26 trillion for roads, power, and other projects, N5.4 trillion for security, […]

todayApril 1, 2026 13

OBODO NAIJA

Senate Approve Tinubu $6bn Loan To Fix Ports, Cover Budget Gap

Senate don approve oga Presido Bola Tinubu request to borrow $6 billion from outside. Chairmo of di Senate Committee on Local and Foreign Debts, Senator Aliyu Wamakko, clear dis mata say, Tinubu write two separate letters to Senate Presido, Godswill Akpabio, asking $5 billion from Abu Dhabi Bank for budget deficit and old debts, and $1 billion from UK Export Finance through Citibank London to fix Lagos and Tin Can […]

todayApril 1, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds